Nigeria vs Ghana: Ghana goment don sama Nigeria reply on 'maltreatment' accuse

President Nana Akufo-Addo

Wia dis foto come from, Getty Images

Ghana goment don react to Nigeria goment claim say dem dey maltreat Nigerians wey dey live for dia kontri.

Ghana minister for information Kojo Oppong Nkrumah say President Nana Akufo-Addo go discuss wit Nigeria President Muhammadu Buhari to solve di mata peacefully.

Di statement add say di kontri dey committed to maintain di relationship wey dey between dem and Nigeria.

On Friday August 28, 2020 Nigeria Minister for Information and culture, Lai Mohammed cut enough is enough warning give Ghana afta dem close retail shops of Nigerians wey dey dia kontri.

Before oga Lai Mohammed warning, plenty gbas gbos don happun between di two kontris and Nigeria goment say dem don dey record all di bad bad tins wey Ghana authorities dey do Nigerians wey live for dia kontri.

But Oga Nkrumah say all di issues wey oga Lai list as di bad bad tins, no be so di tins be for Ghana, dia for: "any protest, decision or action wey base on dis reports go be injustice."

See di rest of di tins wey di Ghana minister tok inside di statement below:

Statement
Statement
Statement
Statement
Statement
Statement