Yusuf Magaji Bichi: Why Reno Omokri, odas dey vex for Buhari

Wia dis foto come from, Getty Images
Social media dey para afta Nigeria President Muhammadu Buhari announce Yusuf Bichi as di new Director General of di Department of State Services because dem feel say di president for don choose pesin wey no come from di northern region.
Wetin pipo dey tok be say why Oga Buhari, wey imsef come from di north, go need to go bring civil servant wey don retire to become head DSS, wen im no give reason why e comot Matthew Seiyefa.
Seiyefa na di pesin wey, last month, di acting president Yemi Osinbajo appoint to replace Lawal Daura wey chop sack because na im qualify for di job pass. At dat time, Seiyefa na di second in command for DSS.
Many pipo, especially from di southern region don carri di mata for head to let Oga Buhari know say e for no dey cari all di big big position give pipo from di north, after all im na president for all Nigerians.
Former special assistant to ex-President Goodluck Jonathan, Reno Omokri tok im mind for di mata, say Buhari don turn di kontri to northern kontri finish.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Many odas for social media no hide am say wetin Buhari dey do na 'nepotism' - wen pesin dey use padi-padi to give odas work.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

Who be Oga Yusuf Magaji Bichi di new DSS oga?
Di new Director-General begin im career for security division for di Cabinet Office inside Kano, from where e join di former Nigerian Security Organization (NSO), wey later come be di present Department of State Service - DSS.
As im dey pursue im career, Oga Bichi don work as di State Director of DSS inside Jigawa, Niger, Sokoto and Abia States.
End of Di one wey oda users dey read well well
E also don be di Director, National Assembly Liaison (National War College), Director at National HQ inside di Directorate of Security Enforcement, Directorate of Operations, Directorate of Intelligence, Directorate of Inspection & Directorate of Administration & Finance.
E also don serve as Director for di State Services Academy.