Lawal Daura: Seiyefa go replace di former DSS oga wey Osinbajo sack

Wia dis foto come from, NTA
Matthew Seiyefa go resume work on Wednesday as di new oga of Department of State Security (DSS), wey be Nigeria secret police.
Acting Presido Yemi Osinbajo on Tuesday sack Lawal Daura di former Director Genral sake of why im men go block National Assembly gate.
Acting Presido tok say di kolobi of di National Assembly na bad tin for di kontri constitution, rule and order.
Seiyefa wey from Bayelsa state southern Nigeria, go take replace oga Daura as acting Director General.
Di new oga of DSS na di second most senior oga before, but as Mr Daura don chop sack.

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency
Di tok-tok pesin for oga Osinbajo, Laolu Akande, na im cari dis informate put for Twitter.
Akande tok say, ''Daura go hand over to di most senior officer of di State Security Service until further notice.''
Im still tok say dis illegal tin wey dem do, wey di presido no join, dem condemn.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis na serious u-turn afta di DSS and Police block di National Assembly gate for Tuesday morning.
Lawmakers wey turn up for one Senate meeting no see chance enta on top dis blockade.
But lawmakers of di ruling All Progressives Congress don wash dia hand comot from wetin di DSS do, even as di opposition Peoples Democratic Party don cari accuse nack dem.














