APC say dia hand no dey inside wetin dey happun for Nigeria National Assembly

DSS

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Tori be say security first block Senators wey no dey support Presido Muhammadu Buhari not to enta di National Assembly complex but dem don allow dem now
Read am in 3 mins

Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) say wetin dey happun for di National Assembly na "strictly legislative mata".

Some senators under di opposition party PDP bin say all di drama for National Assembly wia security bin block gate, na to allow some 30 senators of di ruling APC to remove leadership of di senate.

But APC say na jaguda pipo wan link di party chairmo Adams Oshiomole to wetin dey happun for Abuja.

For statement, acting tok-tok pesin of di party, Yekini Nabena say di party too just dey observe like everi oda "concerned Nigerian and stakeholder".

"No need for all dis lie-lie and attempt to blame di APC National Chairman for wetin dey happun dia", im tok.

Tori be say security first block Senators wey no dey support Presido Muhammadu Buhari not to enta di National Assembly complex but dem don allow dem now.
Wetin we call dis foto, Lawmakers later enta di building

Nigeria Senate President Bukola Saraki bin tweet for morning say armed security men don block di entrance of di National Assembly for Abuja.

Earlier, Ita Enang wey be Senior Special Assistant to Presido Buhari on top National Assembly mata say di president no get hand inside wetin happun Tuesday morning.

Tori be say masked security men first block Senators wey no dey support Presido Muhammadu Buhari not to enta di National Assembly complex, come allow Senators wey dey support di presido to enta.

Di security also block National Assembly workers and tori pipo not to enta di complex.
Wetin we call dis foto, Di security also block National Assembly workers and tori pipo not to enta di complex.
Tori be say security first block Senators wey no dey support Presido Muhammadu Buhari not to enta di National Assembly complex but dem don allow dem now
Wetin we call dis foto, Tori be say security first block Senators wey no dey support Presido Muhammadu Buhari not to enta di National Assembly complex but dem don allow dem now.

APC Senators neva tok fim on top di mata

Senator Isa Missau from Bauchi state bin tell BBC Pidgin say na sad day for democracy as security dey prevent some lawmakers to enta National Assembly while dem dey give cover to some thirty lawmakers from APC wey dey plan to impeach the senate president.

"Na sad day for Nigeria and e bad day at di time wey democracy dey grow for oda Africa kontri, security pipo dey try dabaru democracy," Senator Missau explain.

E say even though PDP lawmakers dey inside, di chambers wen dem dey sidon no dey open and dat APC lawmakers dey try to hold dia meeting under di cover of security pipo.

BBC Pidgin neva use free hand confam wetin di Senator Isa Missau

"If na to elect senate president, u go do am wit simple majority but to remove am, dem need 2/ 3 to do am" Im tok.

Enang say notin concern Buhari for dis mata
Wetin we call dis foto, Enang say notin concern Buhari for dis mata

But Laolu Akande wey be tok tok pesin to acting presido Yemi Osinbajo tell BBC say 'members of di senate don get green light to enta di National Assembly' and im go find out wetin been happun before.

Wen BBC ask Akande weda di acting president no dey in charge of security operatives, im say "di acting president dey in charge but e need to find out more about di allegations."

Dis na some of di tweets wey Bukola Saraki post on Tuesday morning.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Nigeria: Wetin dey happen for National Assembly?
Wetin we call dis foto, Nigeria: Wetin dey happen for National Assembly?

National Assembly emergency meeting

Nigeria Senate

Wia dis foto come from, @NGRSenate

Leaders of Nigeria National Assembly suppose hold emergency meeting on Tuesday afternoon to consider some national issues, according to tori from di Senate Presido office.

Di special assistant to di senate presido for International Relations mata, Bankole Omisore, tweet say di meeting go hold by 12 O'clock.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3