Bukola Saraki: Why Adams Oshiomhole dey ask for di 'crown'

APC National Chairman Adams Oshiomhole dey tok to tori pipo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, APC chairman Adams Oshiomhole say Mr Saraki suppose do di 'honourable tin'

"You no suppose collect crown wey one family get, come leave for personal reasons, come cari am go anoda family"

Na so di National Chairman of Nigeria ruling party, All Progressives Congress (APC), Adams Adams Oshiomhole, describe di mata of how Senate President, Bukola Saraki, comot APC go opposition People's Democratic Party (PDP).

Oga Oshiomhole say di next tin na for oga Saraki to vacate im position.

Mr Saraki bin announce on Tuesday 31 July say im don port go main opposition party PDP.

Bukola Saraki

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP

Wetin we call dis foto, Pipo dey call Saraki ogbonge politician wey sabi play di game

Since den, oda top politicians don follow leave di party - APC publicity secretary Bolaji Abdullahi and Sokoto govnor Aminu Tambuwal dey among.

Wetin we call dis Video, APC mass defection: 'Maybe rice price go reduce'

Mr Oshiomhole tok say dem bin dey expect all dis porting wey happun but Mr Saraki suppose do di right and comot for di position wey im dey.

"Na mata of honour to leave di crown for di house wey get am."

President Buhari dey do meeting wit govnors

Wia dis foto come from, Presidency

President Muhammadu Buhari don do meeting wit govnors and senators wey dey im party before goment announce say im dey go London go rest small.

Buhari

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo

Wetin we call dis foto, Na London President Buhari dey usually go wen im wan see im doctor, but dis time na vacation im dey go

Oga Oshiomhole say true-true, e no go easy for APC because of all di porting wey happun but las-las, na one man, one vote on election day.