Aminu Tambuwal: Sokoto State Govnor don port from Nigeria ruling APC to PDP

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Di govnor for Sokoto State for north west Nigeria, Aminu Tambuwal na di latest to comot di ruling All Progressive Congress (APC) to join di opposition Peoples' Democratic Party (PDP).
PDP confam am for dia twitter handle say oga Tambuwal don return back house.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Wednesday bin no start well for APC, as di National Publicity Secretary of di party Bolaji Abdullahi announce for Twitter say e dey resign from im position and dey comot di party.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
For statement wey im give tori pipo, oga Abdullahi tok say di reason why e comot office na say dem no call am wen dem unlawfully comot who e call "validly elected official" from im state wey be Kwara. E say dis act bin dey disrespectful.
Dis dey come one day afta Senate President Bukola Saraki comot APC.
Why Aminu Tambuwal dey port?

Wia dis foto come from, Twitter/@AWTambuwal
Di govnor for statement to tori pipo give some of di reasons wey e comot di party.
E tok say good governance and di economic well being of Nigerians na im make am do wetin e do.
E follow call out APC say e pass nine million ppo wey don lose dia jobs for di past three years even as e follow add say "I no fit look di pipo wey vote me to be dia govnor show dem any meaningful Federal project wey di APC goment don start for di state."
End of Di one wey oda users dey read well well
Govnor Tambuwal also say APC neva tok on top di electoral promises wey dem bin promise Nigerians wey include how dem go restructure di kontri. Im say dem try but e no work.
As for why e dey go back PDP, im tok say, "I dey enta PDP wit clear conscience because di party don learn bitter lesson dem and don look mistake wey dem go dodge for front. Dem don change dem style to become party wey I dey pledge my loyalty."












