Nigeria 2019 elections: Who run di world? Girls! No be so for Nigeria

Prof. Remi Sonaiya

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Olu Okunnu
    • Role, Broadcast Journalist
  • Read am in 3 mins

11 years don waka since di first woman to run for president in di history of Nigeria try and fail inside di 2011 general election. Now di former Minister of Education for Nigeria, Oby Ezekwesili drop for social media some kain posts wey be like say she sef fit consider to run.

Mojisola Obasanjo for 2007 make history for Nigeria as di first female presidential candidate, and for 2011, Ebiti Ndok run under United National Party for Development wen Olusegun Obasanjo dey run tins for 2011.

Many pipo no go forget di case of Sara Jibrin wey for di primaries of di Peoples Democratic Party (PDP) in 2011, nobody vote for am. Di only vote she get na her own.

Funny tin be say, dat year na di same year popular US singer Beyoncé sing am for song say 'girls dey run di world', but una tink say Nigeria don ready to give women chance to lead dem as dia president?

Make we look three of di female presidential candidates for Nigeria wey dey show strong hand ontop social media, wia young pipo and women boku.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Professor Remi Sonaiya

Even though many pipo believe say she be di first, for 2015, Professor Remi Sonaiya become di second woman for di West Africa kontri to become presidential aspirant and even though she collect only 13,076 votes to finish 12th place for di election, her waka don ginger more women to run three years afta.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Prof Sonaiya hersef go run again for 2019 presidential race to comot President Muhammadu Buhari for power.

Beyoncé

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Beyoncé 'Run the World (Girls)' song popular for 2011, di year one female Nigerian presidential candidate get only one vote for election

Dr. Rosemary Ideh

Dis year, anoda woman presidential aspirant wey come out na Dr. Rosemary Ideh under di Alliance for a New Nigeria party (ANN), wey say her one of her main agenda na to find way to reduce cost and make am simple.

"My administration dey determined from di very first day to enta office, to work to reduce cost... so dat local and foreign investors go succeed," tok to tori pipo.

Eunice Atuejide

Eunice Atuejide too na anoda woman wey dey eye to be presidential candidate for Nigeria 2019 election and for August 2018, she enta news afta she tok for social media say she no be feminist.

Tori be say di kwanta start wen pesin call di 40 year-old lawyer feminist. Atuejide give am reply say make anybodi no call am feminist because dem don spoil wetin di word mean

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Atuejide na di National Chairman of the National Interest Party (NIP) and also di presidential candidate. Her official biography say she don travel to at least seventy-six kontris and fit speak Igbo, Yoruba, German, English and French well well.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post