Why goment di fear e heroes laik Um Nyobe? - Akere Muna

- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
Today mark de day de French colonial master bin kill Ruben Um Nyobe, de first pesin weh e start fight for independence but goment no di ever get mention dis day and na so e di pass laik any oda day.
Barrister Akere Muna, presidential candidate for 2019 elections weh e visist Um Nyobe e grave di wanda why goment di fear e heroes laik Um Nyobe sotei forget dem.
Um Nyobe bin give tok for United Nations General Assembly for 1952.
Um Nyobe na one of de leaders weh e bin take gun for fight colonial with odas laik Feleix Roland Moumie and Ernest Ouandie and French colonial master organise make deh kill e for number 13 day for September 1958.
Founding fada for political party, Union of Cameroon Population, UPC, but today de party don divide, one di support candidate Akere Muna and de oda di support candidate Biya for elections weh e go take place next moon.
Today kontri pipo go mimba Um Nyobe for e tok weh e make sense, "Wen pipo decide for fight for dia freedom and independence you no fit defeat dem".
Akere Muna go visit Um Nyobe e grave for near Boumnyebel for Nyong and Kelle division for centre region, 85,6km from Yaounde.
"Wen ah see de widow tears drop for ma eye, e make me mimba weti di happen for Northwest and Southwest. De same story, ah loss ma cousin, uncle and dia property, na weti deh Um Nyobe go through, de suffer for dia freedom and for this week for heroes, ah happy say a get chance for see dem", Barrister Akere Muna tell BBC New Pidgin.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Cameroon goment di fear heroes, dis goment weh e don fail di wan make we forget wa history, di hideam but we go bring back we history" e add.
Anoda hero weh Barrister Akere Muna wan make kontri mimba na Ahidjo, Cameroon e first president weh e die and e die-bodi still dey for Senegal.
"Ahidjo e die-bodi, e woman and pikin dem go kam and we go start build wa history back and unification weh we fight for", Barrister Akere Muna tok, as e get hope say e go be president and change tins.










