85-year-old President Biya wan spend seven more years as Cameroon president

Wia dis foto come from, AFP
Cameroon President Paul Biya don announce say im go be candidate for di 7 October presidential election.
President Biya tweet for French and English say: "I dey to answer una plenti-plenti calls. I go stand as una candidate for di presidential election wey dey come so."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
President Paul Biya wey be 85-year-old, don dey for power since 1982, and dis make am one of di longest-serving leaders inside Africa. If im win for dis election, e go extend im 35-year-rule.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Under im rule, Cameroon don survive economic crisis and move from one-party state wey dem bin dey before to multiparty politics.
But also serious corruption dey worry for kontri.
For 2008, dem cancel di term limits law and dis open way for Paul Biya to run for re-election for 2011.
Presently, di kontri dey pass through kwanta because of di call to breakaway wey pipo for English-speaking region want.
Di English side dey claim say di Francophone areas wey plenti pass dem, dey treat dem anyhow.
End of Di one wey oda users dey read well well
President Biya goment use force take stop dem, and dis lead to serious clash wit secessionist militias for di Anglophone North-West and South-West regions.














