Cameroon 2018 Election: 'If wuna wan change, make we go new Republic'

Wia dis foto come from, Akere Muna
"I no get party; we no di tok about party but if wuna want change, make we go for new republic, make wuna register, vote and protect wuna vote."
Na Barrister Akere Tandeng Muna, di prominent lawyer wey wan contest for Cameroon 2018 elections talk dis one for interview with BBC News Pidgin.
Some party dem join hand for select Mr Muna to be dia candidate for presidential election dis year as deh bi meet for January 15.
Cameroon go organise municipal, legislative, regional senatorial and presidential election and de platform shidon discuss de agreement.
For 2009 some tori pipo say na de person when e get plenty chance for take over from President Biya.
Oda tori pipo dem for 2010 put Akere Muna e name among de eight candidate dem with big chance for enter Etoudi (presidential palace.
Mr Muna say: "I don dey for political scene for some time but I wanda how pipo be surprise for ma recent political activity"
"Na with 'humility, honour and commitment' weh ah gree dis nomination," na weti yi add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post










