Akinwunmi Ambode fit dey inside hot soup for Lagos as 2019 election dey road

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Olubunmi Okunnu
- Role, Broadcast Journalist
- Read am in 3 mins
Lagos State Govnor Akinwunmi Ambode say im and di National Leader of di All Progressives Congress (APC), Asiwaju Bola Tinubu, no dey kwanta as pipo dey claim.
Im tok dis one as im dey yan wit party members during election of delegates for di Presidential primary election and national convention of di party. Im say all di tori say im and Tinubu dey fight na lie.
Na on Wednesday Ambode submit im form to be party candidate for di All Progressives Congress (APC) party for 2019 election. Oga Ambode wan run again to be govnor of di state.
But di tin be say im don get new opposition wey fit get strong mouth to challenge am for di 2019 elections but dat alone no fit be wetin go make a whole current govnor lose sleep.
Di problem be say, on di same day Oga Ambode collect im nomination form, anoda pesin from im party, Jide Sanwo-Olu, also declare to run for govnor.
Dis one for no be anytin wey serious - because e dey normal for more dan one pesin inside same party to contest di same office - if no be for one video wey show some APC pipo wey claim say former Lagos State govnor and ogbonge politician, Bola Ahmed Tinubu, put hand for chest to support dis 'new' candidate.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Since 1999, everi govnor wey Lagos don get, don serve two-two term, so Ambode must ask imsef wetin wetin fit make im own case different.
Dis na some di tins wey fit cause Ambode palava inside im waka to win dis coming 2019 election:
End of Di one wey oda users dey read well well
Visionscape and PSP palava
Private Sector Participant (PSP) na one program wey di goment of Bola Tinubu bring comot as partnership with private bizness to make sure say Lagos dey clean.
But, ever since Govnor Ambode end PSP to allow one company Visionscape to take over, di city no dey clean again and Lagosians no happi wit am because of dis.
APC Party pipo no support am
One video comot for social media recently wey show some APC party loyalist wey dey tok about dia support for Jide Sanwo-Olu.
Inside di video one of dem James Odumbaku aka Baba Eto tok about how Bola Tinubu dey always bring correct candidate, say if Tinubu support Sanwo-Olu, dem sef go suport am.
Dis one na serious mata for Ambode if strong pipo from im own party no ready to vote for am.
Femi Otedola
Ambode go also need to worry if true true billionaire oil and gas oga, Femi Otedola, wan contest govnor under di People's Democratic Party (PDP).
Dis na because many young pipo sabi Otedola well (as im active for social media) and feel say im na correct biznessman wey also fit connect wit dem. Plus, di kain money wey e hold no be here.

Wia dis foto come from, Femi Otedola Instagram
Wen BBC follow PDP spokespesin Kola Ologbondiyan tok, im say pesin wey need nomination form must come Wadata House (PDP Secretariat) to pick am and dem neva see Otedola dia, but say dem go happy if im decide to run under dia party.
Femi Otedola imsef neva come out to confam or deny say im dey run for office.
And den, no be today we don hear tori of how Oga Ambode get kwanta wit pipo like Babatunde Fashola, di Works, Power and Housing minister, wey Ambode replace as govnor.
Jide Sanwonolu serve as commissioner for di Babatunde Fashola regime and right now im be Managing Director of Lagos State Property Development Corporation inside Ambode goment.

BBC Pidgin call APC Publicity Secretary Joe Igbokwe on dis mata and im response be say "dem (di party) no go tok anytin now", say if kwanta dey, dem go settle am inside di party.











