Jide Sanwo-Olu: Who be di man wey wan pursue Ambode for 2019?

Babajide Sanwoolu

Who be Jide Sanwoolu wey dey trend for Lagos, Nigeria commercial capital wey dey southwest of di kontri?

Mr Sanwoolu name na im dey evribodi mouth now afta e collect nomination form to contest for Lagos govnor for 2019.

Tori be say current govnor, Akinwunmi Ambode, and former govnor, Bola Tinubu, get kwanta so oga Sanwolu na im dey dey arrange to take over next year.

Mr Ambode sef don tok say e no true say e dey fight wit Mr Tinubu, wey be di national leader of Nigeria ruling party, All Progressives Congress (APC).

SANWO-OLU Babajide Olusola

Wia dis foto come from, Other

Im tok dis one as im dey yan wit party members during election of delegates for di Presidential primary election and national convention of di party. Im say all di tori say im and Tinubu dey fight na lie.

Ambode

Wia dis foto come from, Getty Images

Who be dis Jide Sanwoolu

Jide Sanwoolu wey dey im early 50s, na di Managing Director of Lagos State Property Development Company (LSPDC).

Ambode na im appoint am for May 2016 afta im tear-rubber goment enta.

E serve for Tinubu and Fashola goment as Adviser, Commissioner for Commerce and Industry; Budget and Planning; and that of Establishments and Training.

Sanwo-Olu Babajide Olusola

Wia dis foto come from, Lagos State Government

Mr Sanwoolu na Christian, e marry Dr Mrs Ibijoke Sanwo-Olu and dem dey blessed with children.

Im come from Lagos Island and many regard am as public sector expert on top human resources mata and policy formation.

Na banker e be before e turn to politician - serve as Treasurer for di old Lead Merchant Bank Plc between 1994 and 1997, and also as Senior Manager (Head, Foreign Money Market) for UBA and and also work for First Atlantic Bank (now First City Monument Bank).