Zimbabwe go soon announce presidential election result

Woman wey back pikin dey vote for Zimbabwe election

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Zimbabwe elections bin get pipo wey wake for early morning to cast vote.
Read am in 1 mins

Zimbabwe go know who go be dia second elected presido for dia history on Thursday by 9pm west African time.

Di Zimbabwe Electoral Commission announce dis one say make pipo dey calm even as tension don alreadi dey ground.

Dis tori dey come afta opposition Movement for Democratic Change party already accuse di Election Commission weda ruling party Zanu PF dey use style to rig di election.

On Wednesday, three pipo die on top we no go gree wey cause pipo to dey clash wit police and military wey deploy enta street for di kontri capital of Harare.

Tori be say opposition party, Movement for a Democratic Change, candidate, Nelson Chamisa don already dey thank supporters say na im win di election.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis na even as opposition dey claim say dem don rig di election but di electoral commission and pipo wey dey watch from outside di kontri don tok say no be so e happen.

President Emmerson Mnangagwa dey tok say make evri bodi cool temper, even as plenti shops no open today for Harare.