MadonnaAt60: Six eva green songs of 'Queen of Pop'

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo all over di world dey join ogbonge American musician Madonna to celebrate today as she clock 60.
Madonna Louise Veronica Ciccone wey dem born August 16 1958 na also actress, songwriter and business woman rise to become popular during di 1980's.
Di American singer don range successful hit albums wey make pipo start to dey call am di 'Queen of pop'.

Wia dis foto come from, Getty Images
Her songs wey she write and produce herself, "Like a Virgin", "La Isla Bonita", "Like a Prayer", "Vogue", "Take a Bow", "Frozen", "Music", "Hung Up", and "4 Minutes" all reach number one on top chart.
Ray of Light (1998) and Confessions on a Dance Floor (2005) chop Grammy Award.
She post pishure of hersef ontop Instagram to celebrate hersef today where she call hersef di Queen.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
She don do 10 concert tours come sell 300 million records, according to Guinness Book of World Records, Madonna na di best-selling female artist of all time.
Madonna stand out as artist wey dey original, wey dey always push boundary dey change her image again and again.
End of Di one wey oda users dey read well well
Madonna birthday groove dey happun for Marrakesh, Morrocco dis year and people dey celebrate her ontop social media wit di hashtag #MadonnaAt60.

Wia dis foto come from, Instagram/@Madonna
Top six Madonna song
"Like a Virgin" 1984
Dis Dance-pop hit na di first single from her hit album Like a Virgin. Na one of di greatest songs wey di Queen of Pop ever do.
Na Tom Kelly and Billy Steinberg write am.

Wia dis foto come from, Getty Images
"La Isla Bonita" 1987
Dis song wey get Spanish lyrics na di fifth and final single from Madonna True Blue album. E reach number four ontop di Hot 100.
"Material Girl" 1994
Dis song no focus on romance at all, its all about di Benjamins.
Dis song na about wanting to live rich life.

Wia dis foto come from, Getty Images
"Ray of Light" 1998
Madonna use dis song win Grammy award for best dance recording.
Dis single na di title track and second single from Madonna 1998 album.

Wia dis foto come from, Shutterstock
"Die Another Day" 2002
Dis title track from James Bond feem wey dem release for 2002 become di first Bond song wey go climb reach di top 10 ontop di HOT 100 since Duran Duran A View to a kill hiot No 1 for 1985.
"Hung up" 2005
Dis na di lead single inside Madonna 2005 Confessions on a Dance Floor.












