Madonna: My son na im go be Malawi future president

Madonna adopt four pickin from Malawi.

Wia dis foto come from, Ian Gavan/Getty Image

Wetin we call dis foto, Pop singerMadonna adopt four pickin from Malawi.
Read am in 1 mins

Pop star Madonna don call her son- David Banda, "di future president of Malawi," inside di tweet wey she use take praise im pickin wey be 12-year-old.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di US singer get six children, and she adopt four of dem from Malawi.

Di singer bin get palava with Malawi authorities.

For 2013, Malawi accuse Madonna say she dey "bully officials from di country", dem say she dey lie, add money join about her contribution to di country and want make dem give VIP treatment.

Meanwhile, Madonna manager accuse Malawi government say e get "bad belle" against her charity wey dey help di country, and wey she open di same year she adopt David.

Last year, Malawi give Madonna permission to adopt two more pickin, and she be mama to twin baby girls Esther and Stella Mwale.