Why Lady Gaga cancel her European world tour

Lady Gaga

Wia dis foto come from, Brian Samuelson

Wetin we call dis foto, Lady Gaga dey suffer from fibromyalgia
Read am in 1 mins

Lady Gaga don cancel di last 10 dates of her European world tour.

Di pop star post for her Twitter page say she cancel di waka because of "severe pain" - dat pain wey she no fit endure again.

Di singer beg fans for di post say she no really dey happy but she need to take care of herself first .

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tori be say di Grammy award-winning singer get fibromyalgia, condition wey don dey her bodi for long wey fit cause pain all over di body.

Before she announce say she cancel di tour, she bin perform for UK Birmingham Arena on 1 February.