Nigeria vs Morocco: Afcon semi-final fit settle top scorer position between Victor Osimhen and Brahim Diaz

Victor Osimhen and Brahim Diaz

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Brahim Diaz of Morocco and Victor Osimhen of Nigeria na di two top scorers for Afcon 2025 wit five and four goals respectively
Read am in 5 mins

Di Super Eagles of Nigeria go meet di Atlas Lions of Morocco for di 2025 Africa Cup of nations semi-fina.

Di match go hold on Wednesday and sabi pipo say di match go be like final.

Nigeria neva lose one match for dis Afcon and dia style of play so far don dey very impressive. Dem win all dia matches scoring 14 goals wit only four goals against dem.

"I think dis na di best football wey I do see from a Nigerian team for di past 26 years," Ogiame Atuwatse III, di Olu of Warri wey also be ogbonge football fan, tell BBC Pidgin for one interview.

Morocco also neva lose match for dis year tournament but dem play one draw, and dia star man, Brahim Diaz wey dey play for Real Madrid na di tournament top scorer wit five goals in five matches.

Wia, wen and how to watch

Di match go shele for di Prince Moulay Stadium for Rabat and di time na 8 PM Nigeria time.

Fans go fit watch am on top Super Sports.

Wetin dey at stake?

Di ogbonge tin wey dey at stake na a position for di Afcon final and opportunity to lift di trophy.

But also di position of who go be di top scorer for dis tournament fit dey on di line bicos di two strikers for di two kontris na dem dey top di scorers chat; Brahim Diaz of Morroco get five goals and Victor Osimhen of Nigeria get four.

Anoda tin na bragging rights and top positions for di fifa ranking. Di two kontris na super power for African football so nobody go wan gree for di oda.

Morocco na di number one team for Africa according to Fifa but dem rank 11th position for di world, but Nigeria na fifth for Africa and 38th for di world. If di Super Eagles win dis game and go on to win di Afcon trophy, e go surely boost dia position for dat table.

Players to watch

Brahim Diaz: Di Real Madrid man dey very hot for dis tournament as e don score for evri match wey Morocco don play so far. E sure say im presence fit put fear for di bele of di Nigerian defenders.

Victor Osimhen: Na Nigeria number 9 wey don also get goal either goal or assist for almost all di matches so far. One of im strength na im physical presence for di 18-yard box as e dey strong, get good aerial ability and fit finish wit both im right and left legs.

Nigeria never lose any AFCON match wia Osimhen score or assist (W5 D2).

Achraf Hakimi: Di Paris St German full back na one of di best African players for di World right now and di current African best footballer. Hakimi na also current Champions League Champion wit PSG and na dem also hold di French League One trophy. As e no dey around, im club PSG suffer shock defeat to Paris FC for di Coupe de France on Monday.

Ademola Lookman: Di Atalanta of Italy striker wey also be di immediate past African best footballer, don score three goals and get four assists for dis tournament. Im trickery for di penalty area na wahala for defenders and im finishing also dey on point.

Ayoub El Kaabi: Di 32-year old Olympiakos striker don score three goals for open play for dis year Afcon, including two wonderful bicycle kicks. Di Morocco fans don nickname am "El-Kaabicycle".

Alex Iwobi: One of di three Nigerian players for dis tournament wey dey ply dia trade for Fulham FC for England, Iwobi don greatly improve im range of passing, and di result dey show for di numba of goals wey di Super Eagles don score so far. E also necessary to add say Iwobi na di nephew of di great Austin Jay-Jay Okocha, one of Nigeria best footballers of all time

Head to head stats

Overall, Nigeria and Morocco do meet 11 times, di Atlas Lions don win six, di Super Eagles win three and dem draw two times.

For di Africa Cup of Nations, dem don meet five times and na still di Morocco side get di upper hand wit three wins against Nigeria two.

Dia first meeting na for di group stage of di 1976 Afcon wia Morocco beat Nigeria 3-1. And dia last meeting na January 2004, also for Afcon group stage, and Morocco win 1-0.

However, di only time wey dem don meet for Afcon semi-final like dis one, na for 19 March,1980, and Nigeria win wit one goal by Felix Owolabi a.k.a Owo-blow, for di ninth minute.