Nigeria vs Morocco - Meet di referee, oda officials wey go run di show

Wia dis foto come from, Paul ELLIS / AFP via Getty Images)
Di semi-final matches for di 2025 Africa Cup of go start on Thursday, 14 January.
Egypt go face Senegal by 18.00 local time while Nigeria go jam hosts Morocco by 21:00.
Di matches na big games wey dey come wit plenti anticipation and pipo don dey chook eye for everytin including di pipo wey go officiate dis matches.
Names of match officials don trend for di tournament sake of dia decisions wey allegedly end di dreams of some kontris for di tournament.
Infact, some pipo believe say referee follow dey determine weda di match go sweet or not.
So who be di referees wey go officiate for di Nigeria vs Morocco match.
Caf appointed referees
Di Confederation of African football [Caf] organizers of di 2025 Africa Cup of Nations don release di list of pipo wey go officiate for dis match.
Referee - Daniel Niyi Ayi Laryea na di Centre Referee be dis and e come from Ghana.
Assistant Referee 1- Zakhele Thusi Granville Siwela from South Africa and na one of di assistant referees.
Assistant Referees - Souru Phatsoane, Arsenio Chadreque Maringule, di 4th official na Samuel Uwikunda'.
VAR - Di one wey dey cause tok-tok well-well na di referee wey dey in charge of di Video Assistant Referee [Var].
Im name na Abongile Tom wey from South Africa.
Oda officials wey dey on Var duty na Haythem Guirat wey from Tunisia, anoda South African, Stephen Onyango Yiembe and Ghanian Referee Assessor, Lidya Tafesse Abebe
Nigeria and Morocco no find am easy to enta di semi-finals of di 2025 Afcon, dem beat beta teams wey get name to reach dis stage.
Nigeria win all dia Group C matches, sama Mozambique wotowoto for di Round of 16 den clear Algeria for di quarter-finals.
For Morocco, dem top dia Group wit seven points, remove Tanzania for di Round of 16, wire Cameroon 2-0 for di quarter-finals.
Di match on Wednesday na one wey pipo dey anticipate, and in di build up to dat game, fans dey chook eye and dey tok about everytin relating to di game including how di officiating fit make or break am.









