Senegal pepper Mali to reach 2025 Afcon semifinal

ndiaye capitalizes and scores from a goalmouth scramble

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/AFP VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Mali captain Yves Bissouma get red card as Senegal take di lead afta goalkeeper Diarra fail to catch one cross from di left
Read am in 11 mins

2021 Afcon champions Senegal don book dia place for di semifinal of di tournament afta dem sama 10-man Mali 1-0.

Di goal from Iliman Ndiaye for di 27th minute dey enough to seal qualification.

Captain Yves Bissouma get red card for di first half to make his team struggle even more against Senegal wey play well today.

Senegal get plenty chances to score later for di second half but combination of poor finishing and good goalkeeping by Djigui Diarra prevent di Teranga lions from extending dia lead.

Despite di red card, Malik try for di second half to create chances – but dem neva find di way pass Senegal keeper Mendy.

For di end, Senegal win di game wey dem now go face either Egypt or Cote D'ivoire for di semifinals.

Mane and Sinayoko

Wia dis foto come from, SENEGAL FOOTBALL FEDERATION/MALIEENE FOOTBALLFEDERATION

Wetin we call dis foto, Mali qualify for di quarterfinal without a win in dia four games wey dem score only 3 goals

Second Half

90+8" FULL TIME

Dem go face Egypt or Cote D'ivoire for di semis

Referee don blow whistle to end dis game - Senegal don qualify for di semifinals of di Afcon.

90+5" Chaaance! Djigui Diarra don make anoda save for Mali - di goalkeeper don make plenty saves for dis second half to keep Mali for dis game.

90+3" Senegal dey try to find di second goal but Mali neva dey gree.

Di chance don spoil. Mali no fit find dia usual last-minute goal today.

90+2" Kalidou Koulibaly carry elbow whack one Mali player for freekick for promising position.

90+1 min" Senegal hit post for di last minute... what a save from Diarra.

90" Djigui Diarra from Mali don punch di ball away; time now dey go for any last-minute goal but dis na football.

89" Senegal still dey pressure di Mali area but ref blow whistle for foul by Mamadou Traore. Di ref don show am yellow card. Freekick for dangerous area.

87" Senegal win corner kick afta dia pressure, for di last one minute. Dem fit carry dis corner get dia second goal?

86" Mali don waste dia corner and straight for di oda end, Senegal attack bit dem slow di game down to reduce di pressure.

85" Offside! Senegal striker dey offside as Ndiaye dey try to grab di second goal to kill di game.

83" Di time don dey run out for Mali to try and grab sometin from dis game.

81" Dem comot Sinayoko and Sanagare - Kamory Doumbia, Mamadou Doumbia and El Bila Toure dey enta.

80" Lassana Coulibaly and Kalidou Koulibaly don clash wit heads inside di Mali box wey dem dey for ground.

79" Corner for Senegal.

77" Di game dey enta crucial stage now - anoda goal go determine di end of dis game whether Mali go equalize or Senegal go seal am.

76" Chaaaance! Ciss don waste chance for Senegal. Di striker dey one v one wey he dey try to score but Djigui Diarra save di all. Poor shot by Ciss.

74" HABIB Diallo and Ndiaye dey commot for Senegal - Ibrahim Mbaye and anoda Ndiaye dis time Cherif, don enta.

73" Lamine Camara shoot from way outside di box - di ball go ova di bar

72" Time dey run out for Mali to get dia equalizer - dem fit do am again like wetin dem do for dat Tunisia game for di R16 when dem get last minute equalizer?

71" Malick Diouf don foul Diakite - di Mali player vex wey he dey confront Diouf. Di ref rush to calm down di tension.

70" Game don restart - Senegal still dey try to find spaces to create sometin.

69" Ciss stand up afta dem bandage his head - he rush to di bench for anoda jersey to change sake of blood don stain his original jersey.

68" Diakite dey replace Aliou Dieng for Mali.

Ciss don dey receive treatment for di park now.

65" Chaaance! Ciss head di ball from di corner but bifor di ball go reach di goal area, Ciss fall for ground dey bleed as one Mali defender crash his head.

64" Chaaaance! Sadio Mane wit shot from outside di box but Djigui Diarra use strong gloves punch di ball for corner.

62" Senegal don make two changes now - to pepper Mali and try to get di second goal. Papa Ciss and Lamine Camara don enta park.

61" Offside! Ousmane camara meet di Mali freekick wit his head, goalkeeper Mendy make one ogbonge save bifor referee blow whistle for offside.

60" Yellow card for Habib Diallo from Senegal.

59" Senegal waste one chance of dia own. Di game don open now.

58" Wit one man down, Mali dey play well so far dis second half wit dia passes and attacks, but dem dey try to create one more chance; di pass from midfield be too hard.

57" Di corner dey wasted - Senegal now try to turn di pressure into attack but di final pass dey lack.

55" chance! Mali tink say dem don score from one shot from Diaby but Mendy save di ball bifor e comot for corner.

54" Yellow card for Habib Diarra from Senegal for foul.

53" Mali player Amadou HAIDARRA dey comot di game as im dey cry ova shoulder injury. Nene Dourgeles don replace am.

52" Foul by Malick Diouf on Traore. Di Mali player dey for ground as ref invite medical team

51" Chance! Diallo head one ball ova di bar.

50" Di Teranga lions dey pepper di Eagles of Mali for di last few seconds to grab dia second goal, but di keeper and di Mali defense dey guard.

49" Senegal try to score through Iddrisa Gana Gueye but Mali keeper Diarra catch dat ball.

48" Chance! Koulibaly try to pounce to tap dat Koulibaly cross into di net afta Mendy di Senegal keeper hesitate to catch di ball.

47" Mali win possession wey dem dey try to push forward thru Gassama.

46" Senegal begin to pass di ball around slowly bifor dem win throw-in for di far right.

Both teams don comot for park now for second half. Mali fit find dat goal or Senegal go pepper dem and add anoda goal to kill di game?

First Half

Senegal coach Thiaw

Wia dis foto come from, SENEGAL FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "We gat to maintain our defensive balance for dis game also take our chances in front of di goal. We sabi wia we wan go for dis tournament."

HALFTIME!

45+7" Anoda injury stop - Mali player dey sit for ground, medical team enta di park as Amadou Haidarra don hurt

45+6" Chance! Ndiaye cross di ball into di Mali danger area - keeper Diarra use finegertip push di ball away bifor Mane try to shoot for di near post.

45+5" Koulibaly dey guilty of foul on his marker - di Mali player carry his shoulder brush di player im face.

Wit dat red card, Mali now get tough task to overcome dis one. 1-0 down, and one man down.

RED CARD! Ref don give Yves Bissouma, di Mali captain second yellow card as im don dey challenge di ref. Now di ref give am second yellow card.

45+2" Gana Gueye don sit for ground as im hurt.

45+1" Chaaance! Pape Gueye tink say his ball don enta di net from di net but Mali keeper Diarra don make ogbonge save to keep di score at 1-0.

Dem don add five minutes to di game.

45+5 mins

44" Haidara from Mali don hurt as im dey Diatta - he sit for ground wey ref invite medical team to check on am

43" Senegal regain possession now. Di first half go soon end.

Poor corner by Mali as dem waste di chance to pressure di Senegal defense.

42" Corner to Mali for di right hand side - dem fit carry dis set-piece create sometin?

41" Mali try to carry di ball enta di Senegal box - Bissouma chip one ball ova di top but di ball neva find any Mali player.

Di Mali keeper dey struggle for dis game - dat go give Senegal more vim say dem fit score am more goals.

40" Sane hit di freekick, Mali keeper spill di ball again, bifor his defenders clear di ball.

Chance for Senegal from dis area of di park - di edge of di box; close to di corner flag for di right.

39" Sadio Mane don win freekick for di edge of di Mali box afta di defender hack am down.

37" Chance! Habib Diallo pounce on one long ball to shoot on target but di ball don deflect for corner.

Hamari Traore receive treatment, ref go restart di game.

34" Sadio Mane win freekick for di center of di pitch - Habib Diallo try to connect wit one cross inside di Mali area. Di ball comot for goalkick, but di Mali defender don fall for ground

33" Offside! Lassana Coulibaly dey offside as Mali try to enta di Senegal box to create sometin.

Chaaance! Pape Gueye don fire shot from outside di box, di ball miss di goalpost by a whisker.

30" Haidarra from Mali don commit foul on one Senegal player wey he dey apologize to am.

29" Yellow Card for Gueye from Senegal right afta dat goal. Mali players shock well well afta dat goal. but all di blame gatz to go to di keeper Djigui Diarra wey bin spill one weak cross to allow di goal.

Di Mali keeper mess wit one cross from Diatta wey Ndiaye pounce to score.

27" Gooooooal! Iliman Ndiaye from Senegal score di first goal for dis game

26" Senegal keeper Mendy comot to catch one weak ball for di area as Mali try to attack di area.

24" From di corner, Mali don waste di ball again. Senegal captain Koulibaly raise hand to apologize to his teammates for dat mistake wey nearly cost dem.

Chaaance! Koulibaly don dash ball for his area to allow Sinayoko to pounce but Diatta comot di back to clear di ball bifor Sinayoko go tink about striking di ball.

23" Wit dat yellow card, Bissouma go miss di semifinal if Mali qualify.

22" Yellow card! Mali captain Yves Bissouma get di first yellow card for di game for foul on Sadio Mane.

21" Mali try to begin one quick attack from di back, but di end product be poor - Senegal get possession.

Chance! Pape Gueye hit one shot wey bounce off his own teammate bifor e comot di park for goalkick.

19" Di MALI keeper dey alright to continue - from di attack, Sinayoko try to turn but his pass be poor, Senegal now get possession.

17" E neva dey cleqar wetin happun to Diarra there but he dey wince in pain.

Mali keeper Djigui Diarra don sit for floor - as im dey show say he don hurt; medical team already enta di pitch to check on di Mali shotstopper.

16" Kamara from Mali don clear Diatta im cross from di right hand side of di park as Senegal dey try to push to create sometin.

15" Offside! Referee blow whistle for offside against Mali as dem bin dey try to enta di Senegal area.

14" Hiadarra hit di corner but di ball no trouble di Senegal backline wey dem clear dia lines.

13" Corner to Mali - Kalidou Koulibaly follow Sinayoko to clear one dangerous ball for di Mali corner.

12" Afta VAR check as di game bin dey continue, di decision be say di ball wey hit di Mali player hand neva be penalty.

11" Di game dey continue wit Senegal as dem dey try to create sometin wit dia passes, but dem neva find di perfect final ball yet.

Senegal tink dem get penalty as di ball hit one Mali player - ref say e neva be penalty but VAR go check am later to see if na penalty.

10" Di corner neva trouble di Mali defense; dem clear di ball away, bifor ref whistle for throw ball for Senegal.

9" Chaaance! Papa Gueye shoot one ball from outside di box but di effort deflect for corner to Senegal.

8" Ref don call two fouls in quick succession - as di game dey become physical.

7" For di first time since di first minute, Senegal try to create dia own chance wit Habib Diallo, but dem clear his cross from di defensive area.

6" Mali still dey pepper di Senegal area through Amadou Hiadarra - but Sinayoko no fit connect wit his cross from di right side.

5" Game on! Mali throw di ball from di far side, di game don dey continue.

4" Lassine Sinayoko bin dey for ground dey receive treatment afta dat foul. Referee neva change im mind about dat penalty call.

3" Afta di ref listen to di VAR inside his ear, he say di contact on Sinayoko from Kalidou Koulibaly neva be enough for penalty.

Sinayoko fall for ground inside di Senegal box as dem dey try to attack, he dey look for penalty but ref blow whistle for play on.

2" Mali clear dia lines - wey dem dey try to pass dia way out of trouble.

Afta di kickoff, Senegal already begin to pepper Mali - dem almost score quick goal.

1" Referee don blow whistle for dis game to start for di Grande Stade de Tanger.

Afta di anthems, di players shake diaserf bifor kickoff. Make una join us for dis ride

Mali bin dey wear dia green and yellow jersey as Senegal also dey wear white shirt for top and teal colour pants.

Both teams commot di park now as dem begin to recite dia anthems

Di first quarterfinal for dis 2025 Afcon tournament.

Welcome pipo to dis live text commentary between di eagles of Mali and di Tarenga lions of Senegal.

Few minutes bifor di first of two Afcon quarterfinal games go start for di Grande Stade de Tanger.

Mali dey jam wit one-time winner Senegal.

Both teams dey find one spot for di semifinal of di 2025 tournament - but dem gatz to face each oda first.

Mali coach Tom Sainfiet don release starting XI for dis crucial game.

Spurs midfielder Yves Bissouma dey captain di side wey star striker Lassine Sinayoko bon dey lead di attack.

For Senegal, captain Kalidou Koulibaly return to di team afta his red card for di group stage. Al Nassr forward Sadio Mane also dey start for di Teranga Lions.

Mali starting XI: Djigui Diarra (GK); Abdoulaye Diaby, Ousmane Camara, Hamari Traore, Nathan Gassama, Amadou Haidara, Aliou Dieng, Lassana Coulibaly, Yves Bissouma ©, Mamadou Sangare, Lassine Sinayoko

Senegal starting XI: Edouard Mendy (GK); Moussa Niakhate, Kalidou Koulibaly ©, El H. Malick Diouf, Krepin Diatta, Iddrisa Gana Gueye, Pape Gueye, Habib Diarra, Iliman Ndiaye, Sadio Mane, Habib Diallo.

Cocha Saintfiet

Wia dis foto come from, MALIENNE FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "Dem be favourites wey we be outsiders – we don accept dat, but we also show against Morocco and Tunisia say we neva dey fear anybody."

Build up to di game