Liam Rosenior: Who be di young coach wey take over as Chelsea new manager

Wia dis foto come from, Justin Setterfield/Getty Images
Chelsea don confam Liam Rosenior as new manager and na six years contract dem give am.
For statement, di club say dem go 'continue to focus on player development' and 'expectations and ambitions remain high'.
Rosenior say 'to get dis ogbonge role mean di world to me' and 'I go give evritin' to bring success to di club.
Rosenior first match go be against Charlton for di FA Cup on Saturday
Interim manager Calum McFarlane wey tok say im don already speak wit Rosenior last night say im go take charge of di match wit Fulham.
Rosenior dey replace Enzo Maresca wey comot from Chelsea on New Year Day and three members of im staff; Khalifa Cisse, Ben Warner and Justin Walker follow am comot.
Liam Rosenior, na former coach of RC Strasbourg for France, im bin fly into London on Sunday evening to finalise agreement wit Chelsea management.
Strasbourg bin don already start di process to pick candidates wey fit replace Rosenior.
Rosenoir profile
Di 41-year-old Englishman Liam Rosenior bin start im coaching career for Brighton and Hoves Albion as dia unda 21 coach.
E later move to Derby County wia e first work as assistant to Phillip Cocu, and later Wayne Rooney 2021 and 2022, and afta Rooney comot, e bicom di interim manager.
Rosenoir also coach Hull City but dem later sack am, despite say e narrowly miss out for di Championship play-off position.
E move to Strasbourg in 2024 and afta 63 matches e don win 31, draw 15 and lose 17.
"Liam bi dey very important for me," Wayne Rooney tell BBC. "E dey incredible for im coaching ability. I bin work more as di manager and dealing wit players and evritin. So I bin learn a lot from am from dat point of view and den I tink say e don do a great job as a whole."
As a player, Rosenoir play almost all im career as full-back or winger for di English Championship. E bin play for clubs like Bristol City, Reading, Ipswich Town, Hull City and Brighton & Hove Albion.
Im time for di English Premier League na wen e join Fulham in 2003. E play im first EPL match against Manchester United and di match end 1-1 wit Rosenior winning di man of di match.
E also play for Reading FC for di EPL, scoring im first goal for di club for di 7-4 defeat against Portsmoth on 30 October, 2007.
Internationally, e don represent England for di U20 and U21 level, playing 11 times for im kontri and scoring just one goal.
Liam papa, Leroy Rosenior, na also football coach and e bin play under im papa wen Fulham bin send am on loan to Torquay United for di English third division in 2004.
Rosenior also get African heritage. Im papa Leroy na from Sierra Leone and e bin also represent di West African kontri for international football.
Di appointment of Rosenior as Chelsea coach wen e dey finalised go dey massive for young English coaches, Wayne Rooney bin tell BBC Sport.
"We no too dey see English managers for big clubs. So e go dey lead di way for us," e tok.
Di only English managers wey dey currently work for di Premier League na Eddie Howe for Newcastle, Scott Parker for Burnley and Sean Dyche for Nottingham Forest.









