Ebo Noah: From predicting end of di world to police detention
- Author, Komla Adom
- Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
- Reporting from, Accra
- Read am in 7 mins
One go wonder why pesin wey predict say di world go end on 25 December now dey inside police cooler dis new year for Ghana.
Well, di story dey complex.
Because di 33-year-old wey become popular towards di end of 2025 wit im doomsday prophecy say God go destroy di world wit flood, dey face charge of "false publication wit di intention to cause fear and panic".
Ebo Noah wey im real name be Evans Eshun cause drama for social media wen he tok say he dey build ark like di one Noah inside di bible build, to accommodate millions of pipo from around di world when God decide to use flood to destroy di world on Christmas day.
From dat time, many tins happen, God no destroy di world wit flood on 25 December and now Ebo Noah dey inside serious trouble wit police. But how he start dis whole circus?
Ebo Noah content for social media grab attention

Wia dis foto come from, SECURITY GUY MEDIA/FACEBOOK
For im social media account for TikTok, Instagram and Facebook, Ebo Noah tok say he get revelation from God to build ark to save pipo of di world from destruction on 25 December.
Even though he no ever mention di year of dis revelation, Ebo Noah use jute sack as im official costume wey he dey carry big Bible dey move around.
Inside many of im viral videos, he wear di jute sack wey he go dey on top of some mountain or by some river to record di message of di '25 December flood'.
End of Di one wey oda users dey read well well
"My name be Ebo Noah wey I get revelation through dream say make I build ark, sake of God say he go destroy di world. Very soon, I go call everybody in pairs by 25 December, I go finish building di ark," Ebo Noah tok inside one of im first videos on 21 August 2025 as he dey stand in front of one boat wey dem dey construct.
He end dat video by asking pipo to comment "I wan go" if dem wan enta dis ark. Since then, Ebo Noah post series of videos to remind pipo for social media to "repent and accept Jesus" bifor di flood on 25 December.

Wia dis foto come from, EBO NOAH/FACEBOOK
Ebo Noah and di ark wey no ever be
As time dey go, Ebo Noah begi grab attention, Some compare am to di Bible story of Noah when God save im and only seven oda pipo from im family during di flood when he decide to destroy di world.
Even though di Bible later tok say God promise Noah and all living tins afta dat flood say he no go ever destroy di earth wit flood again, many pipo believe say anytin still dey possible.
Ebo Noah begin get plenty followers, afta im videos begin to go viral.
Currently, Ebo Noah get more than 1.3 million followers across social media. Inside public transport, for pubs, streets and offices, many pipo discuss Ebo Noah and im doomsday prophecy.
Until one popular content creator Frederick Mattey alias "Headless Youtuber" eventually find say di pictures and videos wey Ebo Noah dey post for social media no br be ark he dey build.
Frederick Mattey visit di Elmina fishing harbour where he interview fishermen and pipo wey dey build some boats for di harbour wey confam say Ebo Noah take photos for there.
"Ebo Noah come here come take pictures and videos of dis boats we dey build for here. In fact, one day dem even wan beat am as dem see say he dey use di pictures to create content for social media say he dey build ark," one of di fisherman tell "headless youtuber".
"Di time we see di video, we dey laugh sake of we dey here wey we see am when he dey capture everytin, so all be lie. He no dey build any ark anywhere," di fishermen tok.
Despite di gist from di fishermen and oda pipo for di Elmina Fishing Harbour wia he go take pictures and videos of dia boats, e get chance say some pipo still believe say God go destroy di world.
According to social media reports, di tori grab attention of not only pipo for Ghana but from outside Ghana.
Ebo Noah continue to post more videos where he go warn pipo say if dem no enta di ark, make dem blame diaserf for whatever go hapun to dem.
Across social media pipo create content about him and his doomsday prophecy.
But on 24 December, Ebo Noah release anoda video when he tok say God decide to postpone di floods, so e no go hapun on 25 December anymore.
"Through my prayers and intercession of oda pastors, God give us more time to build more arks wey fit contain di millions of pipo wey go come from all over di world," he tok inside di video.
He add say "we go build more arks so tomorrow [25 December], make nobody rush to any location. I no dey sell tickets, I no dey collect money from anybody; so I beg make you stay home and enjoy yourself but make you repent, sake of still we dey build di arks."
Hours afta dat video – Ebo Noah show up for di concert of Ghanaian rapper Sarkodie on 25 December.
He collect microphone on di stage wey di party goers dey where e tok say "we all our prayers work, God dey reveal to redeem, so for now let di party begin".
Dat be how dem start di concert dat night.

Wia dis foto come from, SOCIAL MEDIA
Police arrest Ebo Noah and remand am for custody
On 31 December 2025, di IGP special cyber vetting team arrest Ebo Noah ahead of di watchnight service to cross-over into 2026.
Viral videos for social media show when di police team arrest am wey dem put handcuff for his hand when he still dey wear di jute sack.
Di circuit court for Adenta remand him into police custody wey dem order say make he undergo psychiatric examination for any govment facility bifor dia next court appearance.
Di court wey Angela Attachie dey preside, direct say make dem reappear on 15 January 2026.
On top di charge sheet, di statement of offence be "publication of false news wit intent to cause fear and panic contrary to section 76 of di electronic communication act".
According to brief facts about di case for di charge sheet, di suspect (Ebo Noah) wey be private security guard for Accra, between August and December 2025, publish plenty videos for his Facebook, TikTok, Instagram and YouTube in which he "falsely claim say di world dey come to an end on 25 December wey he dey build ark for pipo wey go dey saved."
Di facts wey Benjamin Owusu in charge of di case write for di charge sheet add say "following one intelligence operation, we arrest di suspect for his hideout for Weija-Gbawe, where he admit for his caution statement say he record and circulate di videos. For social media.
He also admit say di boats wey he describe as ark inside his videos, neva belong to him, but rather dem be for fishermen at di boat yard for Edina for di Central Region."
Benjamin Owusu Gyamfi also explain say, "di suspect admit again say di claims he make be false, wey he tok say no flood dey come hapun wey go destroy di world; all be his own fabrication."
Director for special investigations unit for CID Chief Superintendent Seth Sewornu tok say, "one pesin from Liberia even pack his tins and enta Ghana to find di ark sake of Ebo Noah."
"From our interrogation, he no be prophet, he be private security man for one school, wey he dey hold HND degree from Accra polytechnic."

Wia dis foto come from, SCREENGRAB
Reactions to im arrest
Since im arrest, many pipo including some celebrities dey react. Rapper Sarkodie wey Ebo Noah make appearance for im concert on 25 December, tok say he no know wetin di content creator do wey dem arrest am.
"I no know wetin exactly be di crime of my boy, but from di first day I know he dey create content, unless dem dey charge am wit sometin else," di state broadcaster gbc quote for dia online story.
One popular lawyer Professor Kwaku Asare alias Kwaku Azar criticize di charges.
He write for im social media page say "di issue here no be whether di speech be false, strange or irresponsible. But whether di law wey di state dey quote fit di alleged conduct."
"On di face of di charge sheet, di conduct no fit di charge – section 76 of di law dey to protect public safety not to punish tins wey be absurd or police belief.
Unless di speech dey coupled wit fraud, coercion or real-world disruption, criminal prosecution risk turning di state into arbiter of belief," Kwaku Azar write.
Inside one viral video, pesin wey dem describe as Ebo Noah mother beg di police and di president to forgive her son.
"Wetin Ebo Noah do no good. He no get money to even build di ark. He just use pipo for Ghana and all ova di world to catch cruise. So make you have mercy on him and forgive am."
For now, pipo dey wait 15 January when dem go call di case again for court – when dem go take im plea.
For Ghana, pesin wey dey guilty of publication of false news fit enta prison for up to five years or a fine or both.











