Ruben Amorim sacked as Manchester United manager

Reuben Amorim

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Manchester United don sack Ruben Amorim as manager after 14 months in charge.

Di club currently dey sixth for di Premier League table

Inside statement, Manchester United say dem make di decision 'reluctantly' and 'na di right time to make a change'.

Amorim sack dey come after one explosive press conference on Sunday wia e hint say e no dey happy wit di level of interference from di Man Utd board.

Meanwhile, dem don appoint former Manchester United midfielder interim manager of di side.

Fletcher make more dan 340 appearances over im 20-year time for United.

Dem scout di Scottish midfielder to join di Red Devils at di age of 11 and e go on to win five Premier League titles, two League Cups, one FA Cup and di Champions League.

On Friday, Amorim bin hint say di relationship wey im get wit di club officials don get K-leg. Im bin suggest say di club no go support am for di transfer market.

Amorim wey still play 1-1 draw wit Leeds on Sunday, still drag ogbonge pipo for di club.

Im state say im bin wan work as manager and "not di coach" and im dey ready to leave wen im contract expire in 18 months' time.

E no reach 24 hours wey di club announce say Amorim don "comot for im role as head coach of Manchester United" afta 14 months wey im bin dey in charge.

"Wit Manchester United wey dey sixth for di Premier League, di club leadership don reluctantly make di decision say na di right time to make a change," United tok.

"Dis go give di team di best opportunity of di highest possible Premier League finish.

Di club go like to tank Ruben for im contribution to di club and wish him well for di future."

Amorim coaching team don also comot from United.

Sources tell BBC Sport say di club dey feel say beta evidence of progress neva dey dis season under Amorim.

Manchester United bin appoint Manchester United appoint Amorim as manager for November, 2024.

Di 40-year-old bin win 25 out of di 63 games wey im bin dey in charge of bin replace Erik ten Hag afta Ruud van Nisterooy bin act as interim manager.

Di 14 months wey Amorim spend for United, na di shortest reign of a permanent manager for United since wen dem bin sack David Moyes just eight months into his tenure for 2014.

Former United midfielder Fletcher wey be di under-18 head coach for di club and di former technical director during Ole Gunnar Solskjaer time go be United new manager now.

Even though Fletcher neva hold any senior coaching role before, di 41-year-old former Scotland international bin play for United between 2002 and 2015.

Im bin win five Premier League titles along wit di 2007-08 Champions League

Fletcher go tok for United news conference on Tuesday before dia game against Burnley for Turf Moor on Wednesday.