Bryan Mbeumo deal wit Man Utd - Wetin to know

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Sean Kearns
- Role, BBC Sport
- Author, Simon Stone
- Role, Chief football news reporter
- Read am in 3 mins
Brentford don accept Manchester United £65m bid for Bryan Mbeumo.
Di Cameroon international fit do im medical wit di club bifor Ruben Amorim squad fly out to United States on Tuesday for dia pre-season tour.
Di 25-year-old winger go become United third signing of di summer afta di arrivals of forward Matheus Cunha and left-back Diego Leon.
United bin submit dia first bid - wey bin worth an overall £55m - for di start of June.
Dem fail wit a second bid of £62.5m at di end of dat month.
But di Bees dey satisfied wit United latest offer, wey dey worth an initial £65m and fit rise to £70m wit £5m of add-ons.
Mbeumo, wey bin join di Bees for 2019 from Troyes, go become Brentford biggest ever sale.
Mbeumo don hit im peak?
Mbeumo bin record a career-best figures for di Premier League last season for virtually every attacking metric, including goals and assists, chances created and touches for di opposition box.
Wit a shot conversion rate of 23.53%, na only Liverpool Mohamed Salah and Newcastle United Alexander Isak dey more clinical in front of goal.

Wia dis foto come from, BBC/Opta
Im work out of possession for key areas dey also important. Im win di ball back 32 times for di opposition third, dis rank am third out of all Premier League players.
But perhaps Mbeumo unique selling point na im running threat wit di ball for im feet. Im bin dey responsible for nine carries of more than five metres wey directly end for goal scored for 2024-25 - comfortably di most of any Premier League player last season.
'Mbeumo go need to perform straightaway'
Im don do well for Brentford, but playing for Manchester United dey very different. With respect to Brentford, Dem no get great expectation dia. For United, im go dey expected to perform straightaway.
Im get experience, im be good finisher, and im versatility na big positive - Im fit play as a central striker as well as on di wing, cutting inside from di right on to im left foot.
But im don get just one very good season wia im numbers bin dey very good, so di kwesion now na whether im fit repeat am.
Consistency for those forward positions na wetin United dey strive for, becos dem don see am wit, Alejandro Garnacho or Antony.
Dem feel say maybe an older, more experienced player, wey dey more reliable, na wetin dem need. Dat na Mbeumo - im fit into Ruben Amorim system, and im fit di bill as proven Premier League quality too.
United attack clearly na area dem need to improve. Pipo tok about how dem dey play for back, wit di back three Amorim want, na difficult system to play at times wen you dey try to press high becos all your players need to work hard and dem need to dey really switched on.
Dat na why im dey go for Mbeumo, becos I feel say im dey like pesin wey im fit trust in all areas, in possession and out of it, wit im work-rate and energy im get - and goals too.







