Nigeria waya Zambia 5 - 0 to win Wafcon quarter-finals match

Foto mix of Barbra Banda of Zambia during di FIFA Women World Cup Australia & New Zealand 2023 Group C match between Zambia and Japan and Asisat Oshoala of Nigeria during di 2019 Fifa Women World Cup France group A match between Norway

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Barbra Banda, Zambia/ Asisat Oshoala, Nigeria
Read am in 6 mins

Nigeria Super Falcons and Zambia bin face each oda for di quarter-finals stage as di ongoing Women Africa Cup of nations continue to heat up.

Di Larbi Zaouli stadium, Casablanca come alive for di epic tie wey pipo bin describe as final bifor di final.

But e no tey afta referee blow whistle wey e clear say di Super Falcons dey in charge as dem score dia first goal in di first minutes of di game.

Nine time winners Nigeria show why dem don win di competition for dat many time as dem waya Zambia 5-0 to continue dia campaign for dia 10th title, wey dem call 'Mission X'.

Football pundits bin say di match go tie wrapper as current Women Africa Best Player, Barbra Banda bin face off wit di record six -time African Women Footballer award winner, Asisat Oshoala, but dat one no hapun.

Afta 90 minutes, di Super Falcons maintain dia clean sheet - of not conceding any goal for di tournament so far, while for Zambia, dis na di end of di road for dia dream to win di trophy for di first time - at least for dis year.

How di match waka

Second half

90+4 GOALLLLLLL

85’ Zambia still dey find way to break into Nigeria defence but e Neva work.

81’ Asisat Oshoala of Nigeria get chance she make beta counter attack but no bod to pass ball to bifor di Zambian defence block di ball.

80’ Zambia don dey press Nigeria in di last three minutes but dem Neva see chance to score.

76’ Oshoala bin get chance to score bin she miss di target.

75’ Nigeria coach Justin Madugu don make three ogbonge changes.

Esther Okoronkwo, Echegini and Halimatu Ayinde don comot. Asisat Oshoala, Christy Ucheibe and Deborah Abiodun enta.

Nigeria 4-0 Zambia

69' GOALLLLLLLL

69' Esther Okoronkwo of Nigeria play di Freekick wey Tosin Demihin head into di net.

68' Freekick for Nigeria as Zambian player foul Rasheedat Ajibade

65’ Substitutio for Nigeria, Chinwendu Ihezuo wey score Nigeria third goal don comot and Sikiratu Isah wey be Nasarawa Amazons defender don enta.

62’Substitution for Zambia!

57’ Free kick for Nigeria, Esther Okoronkwo play and afta e hit different players e land for Zambia player leg, dem build counter attack from di midfield but Chinwendu Ohezuo get di ball. She slow down di pace as she pass to Ashleigh Plumptre wey play di ball to safety.

56’ Nigeria and Zambia just dey make goal attempts for each oda post.

54’ Zambia player try to score but e Chiamaka Nnadozie of Nigeria save am.

52’ Zambia Babra Banda clash wi Chiamaka Nnadozie as she bin dey try to score goal. Nnadozie dey receive medical attention 51’ Zambia front man Babra Banda fire shot but Nigeria defence block am.

50’ Nigeria player bin dey down but game don resume.

47‘ Nigeria make two attempts for Zambia goal area but dia goalkeeper catch di ball.

46’ Second half don start and now now Michelle Alozie defend goal attempt from Zambia

First Half

HALF TIME:Nigeria 3-0 Zambia

First half don end

45' Game dey on small break afta players fall for ground. But match don resume.

45' GOALLLLLLLL!!!!! Chinwendu Ihezuo score wen she dey one-on-one wit Zambian goalkeeper.

44’ Corner kick for Zambia afta Nigeria defender clear di ball. Dem play am but notin come out.

43’ Nigeria make goal attempt but Zambia goalkeeper catch di ball.

42’ Zambia fire shot for Nigeria defence but Ashleigh Plumptre block di ball.

40’ YELLOW card for Zambia player sakenof hand ball . Freekick to Nigeria but di ball land for di Zambian goalkeeper hand.

38’ Corner kick to Zambia but dem play am over di bar.

Nigeria 2-0 Zambia

33’GOALLLLLL!!!! Esther Okoronkwo score Nigeria second goal.

31’ Game don start again afta small foul bin happun.

30’ Zambia enta Nigeria goal area and dem try to score but Nigeria defenders clear di ball wey land for Zambia player leg, she fire shot but Chiamaka save di bal.

28’ YELLOW CARD for Nigeria as Demehin foul Zambian player.

25’ Freekick for Zambia but goalkeeper Chiamaka catch di ball easily.

23’ Zambia dey press Nigeria for di last two seconds but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie save am.

22’ Zambia play ball enta Nigeria area but defence save am.

21’ Nigeria get free kick, dem play am but e enta corner kick, dem play am again e enta corner kick again but Notin come out.

17’ Zambia dey show small-small dominance for di game but dem neva get beta chance to score.

15’ Zambia lose ball to Nigeria Chinwendu Ihezuo but di Zambians collect di ball back.

13’ Dem pass long ball give Esther Okoronkwo but the Zambian keeper catch am as e bounce.

8’ Nigeria dey press Zambia as dem dey create chances to score more goals.

5’ Nigeria start di hame hot-hot as dem Dey press Zambia for more!

2’ Nigeria 1-0 Zambia

2’ GOALLLLLLL!! Osinachi Ohale score for Nigeria wit her head as she head di ball enta net.

1’ Referee blow whistle match start

Team news

Wetin di coaches bin tok

Nigeria top Group B wit seven points and dem start wit wit 3-0 win ova Tunisia

Di Super Falcons neva concede any goal for dis competition. E show say dia defence tight and dem get beta structure.

"Our preparations dey good. "We dey try as much as possible to make sure say di girls dey ready," Madugu tok. "Preparations dey okay."

"We dey try to improve our goal conversion. Dis tins dey take time; no be magic. But I trust di girls go make impact."

Zambia, play well too for Group A, dem finish second sake of goal difference wit Morocco.

The Copper Queens play 2-2 draw against di Atlas Lionesses, dem comeback to beat Senegal 3-2 na 1-0 win dem use qualify against DR Congo.

"My team dey ready for di next stage. We move down to Casablanca yesterday [Wednesday] and wey dey excited and prepared for di game."

"Our transition na one of di best for di world," Hauptle tok, "defenders struggle wen we challenge dem wit speed."

She add say dem believe in team unity and mentality: "We no dey look too much on di opponent but focus on our strengths. We believe in unity and love, na wetin drive us."

"We no go allow Nigeria to keep di initiative. On Friday, we go show dem wetin we fit do."