Ihezuo late goal secure Nigeria place for Wafcon quarter-finals

Half-time substitute Chinwendu Ihezuo score di only goal for Casablanca

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Nigeria score late winner against Botswana to become di first side to quarter-finals for di 2024 Women's Africa Cup of Nations.

Na Chinwendu Ihezuo score di only goal for Casablanca in di 89th wit assist from Esther Okoronkwo.

Di victory put Nigeria top of Group B, wit dia perfect record and e assure dem of a top-two finish, afta North African rivals Tunisia and Algeria play 0-0 draw for di early game on Thursday.

Algeria dey second in di group table on four points, wit Tunisia for third afta dem secure dia first point for dis year finals.

Botswana don lose dia two games and fit comot early, afta dem bin reach quarter-finals on dia debut in 2022.

Di final round of group fixtures go see Nigeria face Algeria and Tunisia take on Botswana on Sunday – di two games go happun by 19:00 GMT.

Di final round of group fixtures go see Nigeria face Algeria and Tunisia take on Botswana on Sunday – di two games go happun by 19:00 GMT.

However, di situation for Group B dey somehow afta di Confederation of African Football (Caf) announce say dem don start investigation into "alleged violations" of dia rules and regulations by Algeria for di finals.

Highlights of Botswana vs Nigeria

Second Half

90’ Goal!!! Chinwendu Ihezuo score for Nigeria!

87’ Corner kick for Nigeria Rasheedat Ajibade play am but e land for Botswana player leg.

83’ Corner kick for Nigeria, Esther Okonkwo play am but e land for Botswana goalkeeper hand .

81’ Fine play from Nigeria, afta di players do beta crosses between each oda e land for Esther Okoronkwo leg but she fire di ball inches away from di goal post.

75’ Michelle Alozie of Nigeria pass ball to Rasjeedat Ajibade, wey pass to Chinwendu Ihezuo but her shot land for Botswana goalkeeper Maitumelo Bosija hand.

71‘ Miss! Nigeria just miss beta chance afta Jennifer Echegini wey just enta make goal attempt but e ball land for side of di goal post.

70’ Nigeria dey make goal attempt in di last two minutes but goal neva enta.

68’ Substitution for Nigeria, Jennifer Echegini don enta for Deborah Abiodun.

67’ Botswana Lesego Randiakanyo make solo run but Nigeria defence clear am.

63’ Nigeria player Ashleigh Plumptre play beta shot wey Botswana goalkeeper save go corner kick. Dem play di corner but Notin come out.

62’ Botswana player bin dey ground but match don kontinu.

59’ Botswana striker Mokgabo Thanda make beta solo run to Nigeria area but Nigeria defender clear so ball.

57’ Nigeria create beta chance from di midfield, Michelle Alozie pass ball to Esther Okoronkwo wey dribble one Botswana defender bifor she pass di ball to Chinwendu Ihezuo but w last shot land for Botswana goalkeeper hand.

55’ Freekick for Botswana but Nigeria defender no let di ball pass.

51’ Esther Okoronkwo get chance to score but do ball land for Maitumelo Bosija hand.

48’ Nigeria start di second half wit power wey create beta chance but substitute Chinwendu Ihezuo play di ball ova di goal post.

46’ Substitutions for Nigeria. Asisat Oshoala comot and Esther Okoronkwo replace her. Toni Payne comot and Chinwendu Ihezuo don enta, RI sola Babajide don play finish and Christy Ucheibe don enter.

46’ Second half don start.

Foto collage of Nigeria goalkeeper, Chiamaka Nnadozie [left] wey wear yellow jersey wit ball for her hand and dreadlocks hair and Botswana goalkeeper, Sedilame Bosjia [right] wey wear yellow jersey, hold ball to her chest wit blue gloves and pink design wit low cut hair.

Wia dis foto come from, Getty Images/ Caf

Wetin we call dis foto, Nigeria goalkeeper, Chiamaka Nnadozie/ Botswana goalkeeper, Sedilame Bosija

First Half

Nigeria 0-0 Botswana

45+3 First half don end.

45+2 Nigeria bin get chance but Deborah play di ball wey land ontop net.

45’ Referee add 3 minutes.

44’ Botswana get an attempt on goal but Chiamaka Nnadozie Nigeria goalkeeper catch di ball witout stress.

42’ Play don resume and Nigeria don begin press Botswana again as dem Dey try to create chance to score

40’ Botswana player dey sown dey receive medical attention.

38’ Action no too dey for di last few minutes sake of small - small knocks on players of both sides wey need medical attention.

34’ Chance! Nigeria Toni Payne miss clear chance to score for Nigeria. She fire di shot but Botswana defender save am.

32’ Mokagbo Thanda of Botswana do beta run to Nigeria area but Nigeria defender Michelle Alozie clear di ball to safety.

31’ Botswana no dey give Nigeria breathing space, dem no gree for each oda.

30’ Corner kick to Botswana, notin come out as Nigeria defence clear di ball.

28’ Di match get plenti action from Di blast of di whistle but no goals yet.

25’ Corner kick for Nigeria, Morinsola Babajide play am but Botswana defence no give dem chance.

22’ Goal scare for Nigeria as Botswana get better chance but Nigeria defender clear di threat.

19’ Back to back free kick to Botswana, Mokagbo Thanda play am but e no make any difference.

18‘ Botswana goalkeeper Maitumela Bosija get injury but she don stand up.

15’ Dem bin pause di match becos one Botswana player bin dey ground. Medica don attend to her finish match don kontinu.

13’ Ashleigh Plumptre of Nigeria bin dribble some players, she pass do ball but Botswana defence block am.

10’ Na battle of di midfield now o! Nigeria and Botswana dey drag ball for di centre circle.

7’ Morinsola Babajide dey create chances wit crosses for Nigeria but e neva enta net.

5’ Goal just dey smell for di Botswana area but Nigeria never fit convert for so first few minutes. Dem bin get free kick but Notin come out.

3’ Nigeria Super Falcons don begin rush dia opponents from Botswana wit fine passes and play near dia goal area.

1’ Referee don blow whistle, match don start.