Evritin you need to sabi about Wafcon 2024 finals

Foto mix wey dey show Rasheedat Ajibade wey wear dark green Nigeria kit, di Women's Africa Cup of Nations trophy and Morocco defender Nouhaila Benzina wey wear red kit and headscarf

Wia dis foto come from, Getty Images/Backpage Pix

Wetin we call dis foto, Rasheedat Ajibade of Nigeria and Morocco defender Nouhaila Benzina dey hope to lift di Women's Africa Cup of Nations trophy on 26 July
Read am in 7 mins

Di 2024 Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) dey come closer, as Morocco don ready to host di finals for di second time back to back.

Afta dem push am back wit one year sake of scheduling issues, di tournament go start on Saturday, 5 July wen hosts Morocco go face Zambia for di Olympic Stadium in Rabat.

Pipo wey dey listen to di World Service for Africa go hear live radio commentary of di game, di group clash between Mali and Tanzania, di two semi-finals and di final.

Record nine-time champions Nigeria go also dey in action for di opening weekend, dem go face Tunisia for Group B, while defending champions South Africa go start dia defence against Ghana for Group C on Monday, 7 July.

But wen dem go play di oda group fixtures go happun? Wetin be di format of di tournament? Wia dem go play di matches and wen dis matches go start?

All di tori wey you need ahead of di 13th edition of Africa's biggest women's footballing event dey inside hia.

Wetin be di groups?

Di Confederation of African Football (Caf) share di 12 teams wey qualify into three groups of four teams.

Hosts Morocco get tough assignment for Group A, sake of say dem group dem wit Zambia wey bin beat dem for di qualification for di 2024 Olympic Games.

Di Atlas Lionesses go also face Senegal and DR Congo, di top-ranked side from pot four.

Di draw no too stress Nigeria, wey dey hope to win dia first title since 2018 and dem still remain di top-ranked side for Africa and 36th for di world.

Di Super Falcons go play Tunisia, Algeria and Botswana - di lowest-ranked nations from each pot.

Group C get title holders South Africa wey go play Ghana and Mali, di two teams retuen to di finals for di first time since 2018, and Tanzania, wey dey come di tournament for just di second time afta dem showface for di first time for 2010.

Di top two teams for each group and di two best-ranked third-placed teams go progress to di quarter-finals.

Group A: Morocco, Zambia, Senegal, DR Congo.

Group B: Nigeria, Tunisia, Algeria, Botswana.

Group C: South Africa, Ghana, Mali, Tanzania.

Wafcon 2024 schedule and kick-off times

South African players, wit medals around dia neck on green ribbons, dey celebrate wit Women's Africa Cup of Nations trophy for 2022.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, South Africa go defend di Women's Africa Cup of Nations title wey dem bin win for 2022

Afta di opening match, at least dem go play two matches evriday during di group stage wey go run until Monday, 14 July.

Di matches go happun 13:00pm, 16:00 and 19:00 (all times GMT) during di group stage.

Dem go use di last time 19:00 for di two kick-off time for di final two rounds of group games and di knockout stages, wey go start on Friday, 18 July.

Wafcon 2024 venues: Wia dem go play di matches?

Morocco bin host di Wafcon finals three years ago, but dem no go use di three venues dem use before again dis time.

Di North African kontri dey do plenti redevelopment projects as e dey prepare to stage di 2025 Africa Cup of Nations and co-host di 2030 Fifa World Cup.

Six stadiums will be used in five host cities, with two in Casablanca.

Di stadiums wey dem go use dis time na:

  • Olympic Stadium, Rabat (capacity 21,000)
  • El Bachir Stadium, Mohammedia (capacity 15,000)
  • Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (capacity 30,000)
  • Pere Jego Stadium, Casablanca (capacity 10,000)
  • Honneur Stadium, Oujda (capacity 19,800)
  • Berkane Stadium, Berkane (capacity 15,000)

Who be di favourites?

Barbra Banda dey in action for Zambia, she wear green football shirt wit orange captain armband wey dem write white C ontop

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Zambia striker Barbra Banda, wey be di BBC Women's Footballer of di Year for 2024, don set to be one of di stars of di tournament afta dem miss out on di finals for 2022

Out of di 12 nations wey dey compete for Morocco, only Nigeria and South Africa don win di Wafcon trophy.

Di Super Falcons of Nigeria go travel to di kingdom wey get rich pedigree under homegrown coach Justin Madugu.

Chiamaka Nnadozie na di Africa best goalkeeper for di past two years and forward Asisat Oshoala go brings star quality and di mentality to win.

Coach Desiree Ellis of South Africa dey hope to defend di trophy wit di Banyana Banyana side wey go compete without dia ogbonge striker Thembi Kgatlana sake of of personal reasons.

However, Jermaine Seoposenwe don show hersef for Monterrey for Mexico and Hilda Magaia, wey share di Wafcon golden boot wit her for for 2022, dem go provide a cutting edge in front of goal.

Morocco don invested heavily for football infrastructure in recent years but dia women team neva get di success wey dia men get to becom di top team for di continent.

Atlas Lionesses get di Spanish football coach wey bin don win di Women's World Cup winner in di shape of Jorge Vilda. E bin guide Spain to di title for 2023.

Zambia bin finish third for di last edition and dem get di reigning Women's African Footballer of di Year, Barbra Banda, wey bin dey forced to miss out on di 2022 finals.

Di Orlando Pride striker go form strong partnership wit Racheal Kundananji, and di two strikers dey among di top four most expensive female players of all time. Swiss coach Nora Hauptle go guide di bid of di Copper Queens' afta she bin dey in charge of Ghana.

We go dey ask for too much if we tell di oda eight teams to mount serious challenge for di title, wit Ghana wey be di only nation among dem to appear for di final (1998, 2002 and 2006).

Women's Africa Cup of Nations 2024 group fixtures

Group foto of Morocco players wey stand as dem dey back di fans for di stand and celebrate dia win for di 2022 Women's Africa Cup of Nations. Dem look inside di camera, tight dia hands and shout.

Wia dis foto come from, Backpage Pix

Wetin we call dis foto, Morocco go face Zambia for di opening match for Rabat

All kick-off times GMT.

Saturday 5 July

Group A: Morocco vs Zambia, Olympic Stadium, Rabat (20:00) - listen to live radio commentary on the BBC World Service in Africa

Sunday 6 July

Group A: Senegal vs Ivory Coast, El Bachir Stadium, Mohammedia (14:00)

Group B: Nigeria vs Tunisia, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (16:00)

Group B: Algeria vs Botswana, Pere Jego Stadium, Casablanca (19:00)

Monday 7 July

Group C: South Africa vs Ghana, Honneur Stadium, Oujda (16:00)

Group C: Mali vs Tanzania, Berkane Stadium, Berkane (19:00) - listen to live radio commentary on the BBC World Service in Africa

Wednesday 9 July

Group A: Zambia vs Senegal, Mohammedia (16:00)

Group A: DR Congo vs Morocco, Rabat (19:00)

Thursday 10 July

Group B: Botswana vs Nigeria, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (16:00)

Group B: Tunisia vs Algeria, Pere Jego Stadium, Casablanca (19:00)

Friday 11 July

Group C: Ghana vs Mali, Berkane (16:00)

Group C: Tanzania vs South Africa, Oujda (19:00)

Saturday 12 July

Group A: Morocco vs Senegal, Rabat (19:00)

Group A: Zambia vs DR Congo, Mohammedia (19:00)

Sunday 13 July

Group B: Nigeria vs Algeria, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (19:00)

Group B: Tunisia vs Botswana, Pere Jego Stadium, Casablanca (19:00)

Monday 14 July

Group C: South Africa vs Mali, Oujda (19:00)

Group C: Ghana vs Tanzania, Berkane (19:00)

Wafcon quarter-final fixtures

Friday 18 July

QF1: Group A Winner vs Group C/B 3rd Place, Rabat (19:00)

QF2: Group B Winner vs Group A Second Place, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (16:00)

Saturday 19 July

QF3: Group C Winner vs Group A/B 3rd Place, Oujda (19:00)

QF4: Group B Second Place vs Group C Second Place, Berkane (16:00)

Semi-finals

Hildah Magaia run towards di camera wit arms out to celebrate for South Africa for di 2022 Women's Africa Cup of Nations final, while two out-of-focus Morocco players show say dem no happy wit dia body language for di background

Wia dis foto come from, Backpage Pix

Wetin we call dis foto, Hildah Magaia score two of South Africa goals as Banyana Banyana beat Morocco 2-1 for di 2022 Wafcon final

Tuesday 22 July

SF1: Winner QF1 vs Winner QF4, Rabat (19:00) - listen to live radio commentary on the BBC World Service in Africa

SF2: Winner QF2 vs Winner QF3, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (16:00) - listen to live radio commentary on the BBC World Service in Africa

Third place play-off

Friday 25 July

SF1 losers vs SF2 losers, Larbi Zaouli Stadium, Casablanca (19:00)

Wafcon 2024 final

Saturday 26 July

SF1 winners vs SF2 winners, Olympic Stadium, Rabat (20:00) - listen to live radio commentary on the BBC World Service in Africa