How Senegal become di first African kontri to win England

Cheikh Sabaly dey celebrate

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Senegal defeat England for City Ground for International friendly match
Read am in 4 mins

Wen Cheikh Sabaly score di visitors third goal for City Ground on Tuesday, e stamp a historic win for di records of di Senegal national football team.

Pape Thiaw team complete a 3-1 victory ova England - di first win for an African kontri ova diThree Lions in 22 attempts.

Ismaila Sarr and Habib Diarra earlier bin turn di game in favour of di visitors, afta Harry Kane bin give Thomas Tuchel side early lead for di friendly match.

"Fantastic night. We bin know say we fit do something for dis game," Senegal captain Kalidou Koulibaly tell BBC Radio 5 Live.

"Di game bin dey very tough, but we show our personality, and we show say we fit play for dis level."

Koulibaly relate di win to Senegal Africa Cup of Nations victory for 2022.

"…fantastic. We dey used to making history and we do am wen we win Afcon, im add say we make am tonight,"

"We want to continue to write di story of Senegal. We wan show say our nation good."

Wetin Thomas Tuchel tok: "Disappointing result. I no sure if maybe we deserve a little bit more result-wise, but e feel again like say we freeze, we no bin dey active enough for a long time for di match."

Senegal neva lose match since January 2024, wen as defending champions, Ivory Coast beat dem on penalties for Afcon last-16 stage.

Thiaw take charge for December and now im don win two matches and draw two.

Four of di players for Senegal starting XI for City Ground dey play for Premier League, Edouard Mendy and Koulibaly bin play for Chelsea in di past as well.

According to Opta, for England previous 21 matches against African nations, di Three Lions bin win 15 times and draw six.

Dem bin come close to losing to Tunisia for 1990, bifor Steve Bull rescue a 1-1 draw wit im 89th-minute equaliser against Tunisia for one friendly bifor di World Cup.

England bin need extra time to win Cameroon for Italia 90, wit a 3-2 victory for di quarter-finals.

The last time England chop beating from kontri from anoda continent for di first time na for 2003, wen dem bin lose 3-1 for Upton Park by Australia.

'Na step back'

We bin tink say we go see wetin Thomas Tuchel fit do to dis team. Di next step for di development of dis young, exciting team.

But actually, e look like na step back. Na back to di drawing board. Yes, na friendly but di experiment no work tonight.

Na wetin Leon Osman former Everton and England midfielder tell BBC Radio 5 Live for City Ground

Senegal bin dey better and dem deserve di win, and England dey go into di summer wit dis eye-opening defeat.

England Captain Harry Kane, tell BBC 5 Live say: "Dis na only di manager second camp and we get a lot of young players and inexperienced players at dis level and international football dey different to club football. But no excuses, dis na di reality. We need to dey ready for next season."

Michael Brown former Tottenham midfielder on Football Daily podcast: Di problem we get na wen you no get di results, di pressure dey mount quick-quick and you no fit get [di players] back again for such a long time.