Delap done - Which oda strikers clubs want dis summer?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Michael Emons
- Role, BBC Sport journalist
- Read am in 8 mins
Di battle for Liam Delap don end - afta di 22-year-old striker move to Chelsea from Ipswich for £30m.
Conference League winners Chelsea beat di likes of Manchester United, Newcastle and Everton to collect Delap signature to become di first Premier League club to sign a high-profile striker dis summer.
But wit di clubs wey miss out on Delap deal - plus Arsenal and Liverpool - dem dey among dose wey dey keen for extra firepower, di race to add dose all-important extra goals still continue.
Di first part of di summer transfer window go close on 10 June and reopen on 16 June - clubs get until 1 September to strengthen dia squads.
So which oda strikers wey di major sides dey look at? We focus on 10 forwards wey go dey in demand ova di next few months.
Hugo Ekitike (Eintracht Frankfurt)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 48 Goals: 22 Assists: 12 Minutes per goal: 165.4
French striker Hugo Ekitike, 22, enjoy di best goalscoring season of im career. E register 22 goals and 12 assists for Eintracht Frankfurt to help im side finish third for Bundesliga and dem qualify for Champions League place.
E don represent im kontri at under-21 level and di 6ft 3in (1.91m) frontman bin dey linked wit Chelsea and Liverpool in recent weeks. Frankfurt don already lose one forward to di Premier League dis season, Omar Marmoush join Manchester City - di kwesion now na weda im former team-mate go join am for England?
End of Di one wey oda users dey read well well
Serhou Guirassy (Borussia Dortmund)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 45 Goals: 34 Assists: 6 Minutes per goal: 111.9
Only England captain Harry Kane bin score more Bundesliga goals for 2024-25 pass Borussia Dortmund centre-forward Serhou Guirassy total of 21.
Im also get 13 goals for Champions League (joint top wit Barcelona Raphinha) and dat form don put di 29-year-old Guinea international for di radar of di top Premier League clubs.
Guirassy bin move to Dortmund for only £15.4m last summer and tori be say im get release clause of 70m euros (£60.1m).
Viktor Gyokeres (Sporting)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 52 Goals: 54 Assists: 12 Minutes per goal: 77.8
Former Coventry City striker Viktor Gyokeres dey fine form for Portuguese side Sporting dis season. E score incredible 54 goals in 52 matches.
Di 26-year-old dey linked wit a move to Manchester United, wey fit see am reunite wit former Sporting boss Ruben Amorim, but im goalscoring record dey attract clubs from across Europe.
Im contract according to reports get a release clause of 100m euros (£83.1m).
Jean-Philippe Mateta (Crystal Palace)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 46 Goals: 17 Assists: 4 Minutes per goal: 194.1
Crystal Palace Jean-Philippe Mateta bin enjoy a fine season and im begin 2025 wit eight goals for im first nine games of di year.
Im bin end di campaign on 14 Premier League goals, joint 10th for di charts, and im start for Palace 1-0 FA Cup final victory ova Manchester City for Wembley as di Eagles win dia first major trophy.
Dat victory take im side into next season Europa League, but di kwesion now na if dat go dey enough to convince Mateta to stay for Selhurst Park.
Bryan Mbeumo (Brentford)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 42 Goals: 20 Assists: 9 Minutes per goal: 178
Although im no be recognised central striker, Brentford Mbeumo no be stranger to play dat role for di Bees.
As equally adept on di right, or playing more centrally, Mbeumo go provide option in two positions for any potential suitor.
Manchester United dey interested in di 25-year-old Cameroon international, di likes of Arsenal and Newcastle also dey linked to am.
With just one year left for im contract, Brentford boss Thomas Frank don admit say di club dey open to offers for dia talisman, even though say dem for like keep am for di club.
Victor Osimhen (Galatasaray, on loan from Napoli)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 41 Goals: 37 Assists: 7 Minutes per goal: 85.8
For 2022-23, Nigeria striker Victor Osimhen bin help Napoli win dia first Italian title since 1990, but im miss out on dia triumph dis season but im shine well-well on loan for Turkish side Galatasaray.
Di 26-year-old dey fine form, and among im goals for 2024-25 na double for im side's 3-2 Europa League win ova Tottenham for November.
Arsenal, Manchester United and Chelsea dey among dose wey dey heavily linked wit di player.
Mateo Retegui (Atalanta)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 49 Goals: 28. Assists: 9 Minutes per goal: 112.6
Italy international striker Mateo Retegui bin end di campaign as di top scorer for Serie A wit 25 goals for Atalanta in 2024-25, six more than any oda player.
Di 26-year-old bin play for Champions League for im side dis season, and im goals bin help dem qualify for next season competition. to stay wit Atalanta? A host of Premier League clubs dey watch with interest, ready to pounce if im decide to leave Italy.
Benjamin Sesko (RB Leipzig)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 45 Goals: 21 Assists: 6 Minutes per goal: 155.2
E don tey wey dem dey link Slovenia striker Benjamin Sesko wit a move to Premier League as im continue to build im reputation for RB Leipzig.
Di 22-year-old wey be 6ft 5in (1.96m) no go come cheap becos im sign one new "long-term deal" wit di German side last summer.
For weekend, Sky for Germany bin dey report say Arsenal don begin talks wit RB Leipzig in an attempt to sign Sesko, wey get a release clause worth more dan 80m euros (£67.4m).
Dusan Vlahovic (Juventus)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 41 Goals: 15 Assists: 5 Minutes per goal: 171.1
Serbia striker Dusan Vlahovic, wey im contract no go run until June 2026, na anoda big target wey dey linked wit a move to di Premier League for a long time.
Di 25-year-old wey dey 6ft 3in (1.91m) don enjoy anoda fine season for Italy wit Juventus, wey sign am for January 2022 - wen Arsenal bin miss out on di forward.
Vlahovic also score wen Juventus beat Manchester City 2-0 ifor dia Champions League tie for December.
Ollie Watkins (Aston Villa)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 54 Goals: 17 Assists: 14 Minutes per goal: 210.5
Arsenal bin make a late bid for England striker Ollie Watkins for di final few days of di winter transfer window, wit Aston Villa rejecting di reported £40m offer.
However, Villa 2-0 loss to Manchester United on di final day of di Premier League season wey mean say Unai Emery side miss out on a lucrative Champions League place becos dia goal difference bad pass Newcastle own.
E mean say e go dey Europa League for di 2025-26, so di kwesion na if Gunners go try again for Watkins and get more success wit a summer bid?
Yoane Wissa (Brentford)

Wia dis foto come from, Getty Images
2024-25 stats (all competitions). Appearances: 39 Goals: 20 Assists: 4 Minutes per goal: 153.9
Only five players for Premier League score more goals for 2024-25 pass Brentford striker Yoane Wissa, wey score 19 times.
Nottingham Forest and Tottenham bin dey interested in di DR Congo international striker forJanuary transfer window and Brentford, wey miss out on European football for next season, go face battle to keep Wissa and team-mate Mbeumo.











