Wetin to know about Joao Pedro wey help Chelsea reach Club World Cup final

Joao Pedro

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Joao Pedro new Chelsea signing
Read am in 2 mins

Di 2025 Club World Cup semi-finals on Tuesday see Chelsea sama Fluminense 2-0. as di club new signing Joao Pedro score two goals against im childhood club.

Wen im score di first goal, e no gree celebrate am. According to am, im dey give respect to di Fluminense wey be club wey raise am from age 10.

Di win make Chelsea cruise enta di finals of di Club World Cup and go wait till Wednesday night to know who dem go face for di finals between Real Madrid and Paris Saint German PSG for di finals on Sunday.

Di match na Joao Pedro first match since e join Chelsea few days ago from Brighton.

How Joao Pedro waka reach Chelsea from Fluminense

Joao Pedro dey face anoda player for field

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Joao Pedro wit eyes on di ball

Originally, Joao Pedro dey play for im Brazilian childhood club Fluminense until Watford buy am off to London.

From Watford, e join Brighton for 2023 for a fee of about 30 million euros, e score 30 goals out of 70 matches for di club.

Last week, Chelsea sign am from Brighton for a fee of 60 million euros. Di club offer am eight years contract till 2033 and e no waste time e begin score goals within one week.

Chelsea coach Maresca wey get oda attacking options decide to add am to di semi-final team for di Club World Cup even though na new man for di team, and im decision pay off.

Joao Pedro fit help Chelsea win di Club World Cup?

Over di past three years, Chelsea don invest about 600 million euros for strikers alone wit Joao Pedro as di latest signing.

Di huge investment pay off a bit as di club win di Europa conference league towards di end of last season.

Di club dey hope to lift di Club World Cup dis year but dem get Real Madrid or PSG to face before dem fit touch di trophy.

Joao Pedro say im dey excited to join di team, say di Club World Cup go be im first trophy. “I just join last week and now, I don enta finals” na so e tell tori pipo.

Di Brazilian player na player wey dey full of confidence and fit hold di ball wella for pitch, do leg work and dey good at goals.

Chelsea still get oda strikers for di team wey include Raheem Sterling, Liam Delap, Nicolas Jackson, Joao Felix and Armando Broja but Pedro na like di hottest cake in town.

Koko be say e never ever score more dan 11 goals for one season, dis dey raise questions weda im go fit actually be di Chelsea Messiah di season.

Who be Joao Pedro?

Im original name na João Pedro Junqueira de Jesus. Dem born am for Brazil on 26 September 2001.

E join club Fluminense for 2011 wia e score 5 goals for dem. UK club Watford sign am for 2020 and e score 23 goals for dem.

E join Brighton for 2023 and Chelsea for July 2025.

E be member of di Brazil National team and e never score for di team before.

E never play Champions League football before, im signing to Chelsea mean say e don get im first chance to play for Champions League.