Nigeria open Wafcon tournament wit 3-0 win over Tunisia

Rinsola Babajide celebrate her goal against Tunisia for Wafcon 2024

Wia dis foto come from, @NGSuper_Falcons

Wetin we call dis foto, Rinsola Babajide score Nigeria second goal against Tunisia
Read am in 9 mins

Di Super Falcons of Nigeria beat Tunisia for di first time for Women Africa Cup of Nations wit a brilliant 3-0 win.

Nigeria face Tunisia for dia opening Group B match on Sunday wey shele for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca.

Na Nigeria star player Asisat Oshoala score di opener wey put di Super Falcons in di lead ahead of Tunisia for di 4th minute.

Brilliant play from di Nigerian team really give di Tunisia side some big worry as dem try return goals but goalkeeper Chiamaka Nnadozie no gree for di post.

Nigeria double di lead bifor half time wit a goal from Omorinsola Babajide wey score just bifor halftime.

Di VAR bin first check di goal and e no clear wetin di VAR dey check weda na off abi na foul, but referee come back to blow 'goal allowed'.

Tunisia goalkeeper Soulaima Jabrani really try her best for goalpost as she deny Abiodun from scoring Nigeria third goal.

Afta halftime, Nigeria make three straight substitution wey see Oshoala comot and Chinwendu Ihezuo replace her.

On di 84th minute, substitute Ihezuo put di ball directly for back of di net to make di score line 3-0.

Dis na di second time in history wey Nigeria go meet Tunisia for di Women Africa Cup of Nations and di Falcons show dia colour as experienced team for di tournament.

Di only time Nigeria and Tunisia don meet bifor na for Wafcon 2008 wen dem play goalless draw, for Bata, Equatorial Guinea, but for dis game, three goals from Nigeria bin make di difference clear.

Victory for di Super Falcons see dem go top of Group B wit three points after dia first group game. Algeria dey second wit three points following dia 1-0 victory over Botswana.

Nigeria go meet Botswana on Thursday 10 July while Tunisia go play Algeria on di same day.

Nigeria vs Tunisia minute by minute report

Nigeria 3 vs 0 Tunisia

Tank you for staying wit us for di live commentary for di ongoing Wafcon wey dey go on for Morocco

Dis game really totori pipo and fans wey watch am. Nigeria don get three points for di opening Group B match wey shele for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca.

FULL TIME

90+4mins- Tunisia goalkeeper Jabrani really see betta ball catch for dis game, but three still enta di net. She punch ball well well and she catch for ground too from weak shot wey Nigerian strikers dey fire.

Anytin fit happun but e dey clear say Nigeria don win dia first Wafcon game against Tunisia wey still dey find atleast one goal wey dem fit carry go

SUBSTITUTION-

90+2' - Late change for Nigeria asJennifer Echegini come on to replace Halimatu Ayinde.

5MINUTES ADDED TIME

90mins - Pressure don dey ooooo, as di game dey enta di final minutes. Alozie just dey find correct pass give her colleagues fro di middle

88mins- Alozie and Ucheibe wit correct square play for front of Tunisia half side, dem dey find anoda opportunity to score

86mins- Demehin chop yellow card afta a hard tackle.

Chinwendu Ihezuo find di bottom corner wit a composed left-footed finish to extend di lead wit three goals. Dat na veri easy goal.

Nigeria 3 vs 0 Tunisia

84mins- GOOOOOOOOAAAAAAAAAAAAAALLLLLLLL

82mins- Nigeria goalkeeper just dey gidigba for post.

SUBSTITUTION- Payne on comot for Folashade Ijamilusi.

80mins- Yeeeeeeeeeeeeeeeeeeee. Di ball no enta oooooooo. Missed chanced for Nigeria as di ball hit di goalpost

77mins- Dis go be foul? Referee dey check di VAR to confam wetin happun inside Nigeria box 18. No penalty for Tunisia

Ball is back in play

Di two coaches dey give dia players some tok

71mins- Cooling Break

FREE KICK for Nigeria. Dat ball no strong reach.

70mins- Heavy pressure from from di Falcons, lovely passes, nice SKILSS by Esther Okoronkwo as she dribble pass di Tunisia defender. Again Jabrani catch di ball

67mins- Plumptre be like di playmaker for Nigeria wit her long hand throw, di ball land for Ajibade front, e reach Okoronkwo leg, she pass give Alozie. Oh, di ball go ova di post

65mins- Ajibade wit di run, but di ball go outside to goalkick. Plumptre wit good dribble, but dis Tunisia midfielder no allow her move

62mins- What A MISS!!! Osinachi Ohale miss dat beautiful chance for front of goalpost? Dat for give Nigeria three goals

Ajibade wit di dribble, kaiiiii, Tunisia player Lamti don drag am fall for ground oooo

61mins- Nigeria coach and im Tunisia counterpart don stand to conteol dia players for field, as di match dey enta hot stage

59mins- Ayinde wit a lonnnnnnnngggggggg shot, dat was brilliant, but e go ova di bar to di side of di post

Nigeria 2 vs 0 Tunisia

57mins- Tunisia dey desperate for a goal.

55mins' SUSTITUTION - Bettoumi out for Elounzi of Tunisia

54mins- Plumptre creat good chance for Tunisia box 18, Ucheibe take di ball, good touch dia, she pass am go forwar, oh no, Tunisia goalkeeper don catch am

Dis Tunisian goalkeeper na dia saviour, if not, Nigeria go don score plenti today wot different shot from Ohale, Ajibade and co

53mins- Beautiful punch by Jabrani, dat na unexpected ball from di angle wey Nigeria striker put am.

Tunisia go need carry betta player go front if dem wan score for Nigeria hand, becos di defenders no dey joke

52mins- E neva clear how dis match go end, but Nigeria lead dey totori dia fans.

50mins- Ohale wit di ball, long beautiful shot dia, but dis Tunisia goalkeeper punch am again.

Zemzem trying good chances for Tunisia but she no fit convert am for front.

CORNER KICK for Nigeria

48 mins- Nigeria dey play from di half side of di field. What a long shot from di Nigeria striker, but Tunisia goalkeeper Jabrani punch di ball go corner. Veri good chance

46mins - Okoronkwo wit good tackles against di Tunisian player. Two of dem don fall yakata, referee blow

SUBSTITUTION' Christy Ucheibe replace Deborah Abiodun, Esther Okoronkwo come on for Rinsola Babajide and Chinwendu Ihezuo replace Asisat Oshoala

Nigeria make three seperate substitution at once

Nigeria 2 vs 0 Tunisia

Welcome back to second half of di Nigeria vs Tunisia game

Nigeria Super Falcons Captain, Rasheedat Ajibade

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rasheedat Ajibade

Second half

Nigeria 2 vs 0 Tunisia

HALF-TIME

Di goal no stand. Referee cancel am

45+5mins - Oh dat no be goal? Tunisia goalkeeper try punch di ball out but e still enta. Referee neva decide yet weda na goal

CORNER for Nigeria.

45+3mins- Good tackle for front of Tunisia defence Oshoala dey find her second goal.

Di game kontinue.

IT IS A GOAL for Nigeria.

45+1 mins- Babajide Omorinsola score. But VAR dey check am ooooooo. E neva clear wetin di VAR dey check weda na off abi na foul

Nigeria 2 vs 0 Tunisia

GOOOOOOOOOOOALLLLLLLLLL

45' Five minutes added time.

GOAL KICK for Tunisia

44' Asisat Oshoala miss clear chance to double Nigeria lead. Oshoala no touch di ball well.

41mins- Alozie wit di dribble, good run for di front of Tunisia defenders. But why she not cross am? Weak ball into di hand of Tunisia goalkeeper Jabrani

39 mins- Oh nooooooooooo. Collision! One Tunisian players clash collide wit Nigeria goalkeeper, medical pipo dey attend to dem.

38 mins- FREEKICK to Tunisia, dem play am but Chiamaka punch di ball to safety.

37 mins- Deborah Abiodun attempt goal wit beta shot but Tunisian defend block di ball wey finally land for dia goalkeeper hand.

36mins- Tunisia keeper Soulaima Jabrani dey enjoy some poor shot from Nigerian players, and she dey stop dia shot. What a goal miss dia, but di shot no hard

35 mins- Ajibade wit di strike! but e cross di goal post. As a playmaker, Ajibade dey give betta cross, but e neva convert to goal yet.

33mins- Oh What a weak shot from Payne, she position hersef well, den she shoot straight to di post but di shot no hard. Tunisia keeper catch am

32 mins - Incredible dribble by Aouina, she dribble Osoala comot for road for middle of di field.

Nigeria 1 vs 0 Tunisia

30 mins- FREE KICK for Tunisia. E no too strong, e stop for middle of di field as Bayahia try move wit di ball

29 mins - Match resume afta di cooling break. Lamti wit super play

28 mins- Cooling break

27 mins- Ohale and Demehin trying to create chance for di middle

26mins- Zemzem take di ball forward for Tunisia, little pressure for Nigerian defenders. But e throway di ball to di hand of Nigerian defenders. Chiamaka catch di free kick wey Tunisia play, veri easy catch for am

25 mins'- Tunisia play one weak pass but na easy catch for Chiamaka afta Nigerian defender pass di ball to her.

24mins - Match don resume and dem dey drag ball for midfield

22 mins- Injury for field two Nigerian players clash wit Tunisian players, dem dey get medical attention.

Medical attention for di players wey dey down. Wit big shout for di stadium wey no dey so full.

21mins- Oh wat a tackle. Deborah Abiodun great tackle from her as she collide wit jersey number 6 of di Tunisian women Raina Aouina

20mins ' Tunisia carry ball near Nigeria goal area but notin come out.

19 mins' - Nigeria miss beta goal opportunity as Tunisian defend block di ball.

19 mins' Nigeria Super Falcons dey press di Eagles of Tunisia

18mins- Risola Babajide play di corner kick dem head am off target.

17mins- Miss! Toni Payne cross ball give Oshoala but e miss di net

9mins - Lamti wit di ball trying to find way to give im fellow Tunisian players

Nigeria 1 vs 0 Tunisia

Oshoala score a beautiful goal to put Nigeria for di lead

4mins- GOOOAALLLLL

0' Nigeria dey face Tunisia for dis game and e go be an interesting one

Welcome to to di live commentary of game between Nigeria and Tunisia for di ongoing Women African Cup of Nations for Morocco

Nigeria vs Tunisia

First half

Nigeria Super Falcons go start dia Women's Africa Cup of Nations campaign on Sunday.

Dem go face Tunisia for dia opening Group B match wey go shele for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca.

Dis na di second time wey dem dey meet for di Women's Africa Cup of Nations.

Di only time dem bin meet before na for Wafcon 2008 wen dem play goalless draw, for Bata, Equatorial Guinea.

Nigeria Coach, Justin Madugu say "We dey prepare veri well and di girls dey respond positively ...we dey good to go!."

Coach Madugu add say dem need to show respect to evri team wey qualify for dis finals.

"We no dey take anybody forgranted sake of assumption say we don win all our previous games against nort African teams becos e go dey easy, no game dey easy" im conclude.

Super Falcons Captain Rasheedat Ajibade say "evritin dey go well, di backroom staff dey make sure say dem do evritin to make di team respond positively, we dey do evritin to make sure say we perform well for all our games".

Head coach of Tunisia Kamel Saada say "Nigeria get good players and Tunisia get good team even though dem no dey experienced. but we fit start well against Nigeria. Nigeria na favourite but as far say we [Tunisia] qualify we fit get sometin out.