Tears flow as family and football stars gada to lay Diogo Jota and im broda to rest

Former teammates carry the coffin during the funerals of Liverpool's Portuguese forward Diogo Jota and his brother Andre Silva at the Mother Church of Gondomar, on the outskirts of Porto, on July 5, 2025

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Dem don bury Diogo Jota and im broda Andre Silva on Saturday 5 July afta dia deaths for car accident wey happun for Spain on Thursday.

Di funeral service happun for Igreja Matriz de Gondomar for Sao Cosme.

Family and friends bin walk into di church, wit dia heads down. Complete silence bin dey inside di church hall, nah only di bell bin make sound.

Many pipo bin cry and wipe dia tears away. One signpost wey dem hang for up bin show: "Para sempre um de nós." (Forever one of us). As di bell stop to dey ring, many fans clap inside di church hall.

Dem start di funeral at 10am on Saturday morning, wit di Lord's Prayer, wey pipo dey hear outside di Catholic church hall.

Liverpool players, staff, fans and odas bin attend to pay dia respects at Diogo for di ogbonge footballer and im broda.

Join Pidgin WhatsApp Channel to read more tori on Diogo Jota and oda ogbonge footballers.

Foto of Diogo Jota and im broda André Silva

Wia dis foto come from, Getty Images

Members of di brodas family bin carry dia caskets into di church while Jota Liverpool teammates, Virgil van Dijk carry wreaths into di church.

Diogo Jota marry im long-term partner Rute Cardoso 11 days bifor di accident, as im and im broda dey travel inside Lamborghini in di early hours of Thursday morning.

Football players from Liverpool, Portugal national team and oda teams members of Diogo Jota and André Silva bin walk into di church for Godomar to pay dia respects.

Di scene bin dey really sad, and all di players wey arrive dis morning dey moved by dia emotions as dem dey wipe dia tears for di church hall.

Afta di church service, dem bin gada outside to bury Diogo Jota and André Silva for cemetery.

Family and friends accompany follow dia coffins as Ave Maria ring out from di church speakers and di bell begin to ring once again.

Tributes pour for Jota

Foto of Francisco Silva

Hundreds of miles away from Anfield, for Liverpool, mourners bin pay dia respects to Diogo Jota.

Ten-year-old, Francisco Silva tok say Jota na im favourite player and e bin wear player number 20 Liverpool shirt.

E tok say na Jota sign am wen im visit im school two years ago.

Anoda fan, Carlos, tok say im grow up to dey watch Jota as e dey play, and im travel for one hour to come dia to pay im respects.

"E get big impact on young kids for di region. Good footballer but great human being," e tok.

One Gondomar local Fábio Silva wey don dey follow Diogo Jota career since e start in di local Portuguese clubs tok say e get one reason why e dey dia: "Respect for di brodas, di family."

Silva tok say e sabi di family and e don spend some time wit dem ova di years - im Liverpool shirt dey marked wit Jota autograph. "Hug to Fábio," di message tok.

E tok say pipo wey dey dia dey deeply hurt by dia deaths, and evrione know dem as humble family.

"Despite di impact e get on football, and even financially, dem no let am show,' e add. "Di community dey sad, devastated," e tok.

E hope say Liverpool go retire di number 20 and continue to honour Jota from now.

Some fotos from di funeral

Joaquim Silva, father of Diogo Jota And Andre Silva, consoles Isabel Silva, mother of Diogo Jota And Andre Silva, as they arrive in the procession at a funeral held for Diogo Jota and his brother Andre Silva at Igreja Matriz de Gondomar on July 05, 2025

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Joaquim Silva, papa of Diogo Jota And Andre Silva, console Isabel Silva, mama of Diogo Jota And Andre Silva.
Ruben Neves, football player for Alhilal Saudi Club and the Portugal national team, and his wife Debora Lourenco arrive at a funeral held for Diogo Jota and his brother Andre Silva at Igreja Matriz de Gondomar

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ruben Neves, football player for Al-Hilal Saudi Club and di Portugal national team, and im wife Debora Lourenco
Danilo Pereira, football player for Al-Ittihad Club and the Portugal national team, with his wife Jessica Widenby

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Danilo Pereira, football player for Al-Ittihad Club and di Portugal national team, wit im wife Jessica Widenby
Diogo Jota's and his brother's funeral

Wia dis foto come from, Getty Images

Diogo Jota's and his brother's funeral

Wia dis foto come from, Getty Images