Chelsea waya PSG 3 - 0 to win Fifa club world cup final

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea defeat Parsi St-Germain (PSG) for a wrold class game to win di Fifa Club World Cup final match.
For front of di MetLife stadium wey get attendance of ova 81,118, Chelsea display and deliva di unbeliavable. Dis na di biggest attendance of di tournament.
Two-goal Chelsea star Cole Palmer dey named as di 'superior player of di match'.
Afta recording two assists for di Conference League final, Cole Palmer dey involved for three goals today.
Palmer na di second Chelsea player for di Premier League era to record multiple goal contributions for multiple finals afta Drogba for di 2005 Community Shield and 2007 EFL Cup.
Afta di match, small kwanta bin wan shelle between di rival sets of players wia Joao Pedro dey for ground. But dem later settle am.
How Chelsea vs PSG take waka
FINAL WHISTLE
Di final whistle go loud.
Chelsea na di champions of di world.
90+3mins - Enzo Maresca even get a smile for im face.
90+2mins- Chelsea bench dey on di sidelines ready to race on for di final whistle.
Five minutes time.
90mins- PSG fit dey here for anoda week and make dem no score. Di ball just hit Goncalo Ramos for di six-yard box.
YELLOW CARD' Ousmane Dembele dey booked for PSG.
88mins- Nuno Mendes blast one in for PSG, blocked by Malo Gusto.
86mins- RED CARD' E be like Joao Neves know say dis dey come. E see di red card and run straight off. E pull Marc Cucurella hair.
82mins- Chelsea goalkeeper Robert Sanchez get anoda save for im collection, dis time to frustrate Bradley Barcola.
Liam Delap almost make am four. E get past di last man too easily but e dey denied by Gianluigi Donnarumma.
80mins- Ten minutes remian. Luis Enrique dey look frustrated.
77mins - Chelsea send on Christopher Nkunku and Kiernan Dewsbury-Hall for Reece James and Pedro Neto.
75mins- Marc Cucurella go down and Joao Neves try to pull am to im feet but di Chelsea player no wan gree.
70mins- Drink Break
69mins - Cole Palmer slice a volley wide from a Chelsea corner.
68mins- PSG get more shots on target dan Chelsea today.
67mins- No golden boot for Joao Pedro. SUBSTITUTION' Standing ovation for Chelsea goalscorer Joao Pedro, Liam Delap replace am
65mins- Lev Yashin, sorry Robert Sanchez dey di Chelsea goal to come and catch Vitinha free-kick cross well.
Three players squeeze out Desire Doue as e try to go and between dem dem foul am.
Chelsea dey warm up to become world champions again.
63mins - Cole Palmer beat Fabian Ruiz for a good duel. Moments later di pair clash but e no turn to fight.
61mins- SUBSTITUION - Chelsea captain Enzo Fernandez seem to get a knock. E dey limp off wit Andrey Santos to take im place.
60mins- Vitinha don go from 30 yards out and Robert Sanchez tip am wide. Fantastic save.
58mins' SUBSTITUTION- PSG make dia first sub as Bradley Barcola replace Khvicha Kvaratskhelia on di wing.
55mins- Desire Doue smash a shot wide from 22 yards out. If PSG fit score e go change evritin. Chelsea gatz keep dem out.
51mins- PSG dey much betta for dis second half. Vitinha glide forward but im through ball dey cut out by Marc Cucurella.
48mins- Lucas Beraldo carry ball pass Malo Gusto for di back and Chelsea get a free-kick to take dia time ova. Cole Palmer cross dey ova evrione head.
47mins- Now Robert Sanchez save and spill- Khvicha Kvaratskhelia shot from di edge of di box. Very positive from PSG
46mins - Dis half-time break last for 24 minutes.
SECOND HALF don resume
Chelsea 3 - 0 PSG
HALF-TIME
45+4mins- Chelsea defenders dey show great strength to just knock off PSG players as dem try to attack.
45+2mins- Na brave header from Neves but Sanchez dey equal to absolutely evritin for dis first half.
Six minutes added time.
45mins- Chelsea dey press so impressive here. Dem even do am for a short PSG corner and di European champions end up playing a bad pass out of play
Chelsea 3 - 0 PSG
43mins- WOW!!!
Chelsea dey in complete control now. Cole Palmer slip in a fine ball to Joao Pedro, wey just clip di ball ova PSG goalkeeper Gianluigi Donnarumma from 10 yards out.
GOOOOOOAAAAAAAALLLLLLL
40mins- Oh a waste for Chelsea. Dem get a chance for a big counter wit loads of space behind but Pedro Neto cross dey poor.
35mins- YELLWO CARD' Chelsea Pedro Neto end up chopping yellow card.
Cole Palmer don become di third Chelsea player to score multiple goals for a final dis century, joining Didier Drogba (twice) and Eden Hazard.
33mins- E don do am again!!! Cole Palmer finish dey identical to im first, but di build-up play dey fantastic.
E run into a ball down di right and cut in. Palmer den send Lucas Beraldo to di ground wit a dummy bifor e slot di ball for di bottom corner from near di edge of di box.
Chelsea 2 - 0 PSG
Cole Palmer score again.
30mins- GOOOOOOOOAAAAAAAAAALLLLLLLLl
Well now, Chelsea dey lead di European champions for di Club World Cup final.
Dem block Malo Gusto shot and Cole Palmer take ova bifor e place a shot for di bottom corner from di edge of di box.
22mins- GOOOAAAALLL. Cole Palmer score for Chelsea
19mins- Now PSG get a shot and na good one. Desire Doue blast one in from di edge of the box and Robert Sanchez get down low to save am.
10mins- Be like say PSG dey troubled like dis ooooo. Achraf Hakimi tackle brilliantly as e try to go forward.
5mins- Chelsea get an electric start. Cole Palmer dey fly down di right dis time. Dem go fit take advantage of dia early dominance?
3mins- Ousmane Dembele feed Khvicha Kvaratskhelia down di left but im cross dey headed out by Marc Cucurella.
Cole Palmer try to start a counter but e no release di ball to Pedro Neto.
0mins - Game don start wit full energy
Chelsea and Paris St-Germain dey play di final of di Fifa Club World Cup afta dem win dia semi-final game.
Both teams wey football fans and pundits don describe as a clash between di favourite and underdogs dey hold for di MetLife stadium, New Jersey.
European champions PSG dey hope to wia dia fifth trophy dis season.
Conference League champions Chelsea dey look forward to add to dia trophy.
Minus di of winning a trophy, beta money join dis tournament as winners go get extra £7.3 million for prize money.
Chelsea and PSG win all dia last four matches for di Fifa Club World Cup
Head to head, Chelsea and PSG don meet 11 times for all competitions.
Both clubs win three times each and dem draw five times.
Chelsea coach, Enzo Maresca need to play beta tactical game to win dis match against PSG wey dey in top form and Luis Enrique wey do first ever Champions League title for PSG need to maintain both attacking and defensive tactics against former winners Chelsea.
Di new format Fifa club World Cup don start for di United States of America among 32 clubs.
Bifor di competition na among seven teams, wia dem dey play am every year, but now di tournament go happun every four years.
Ogbonge clubs for di world dey participate including Chelsea, Manchester City, Bayern Munich, Real Madrid, Paris Saint Germain and odas from di oda continents including Lionel Messi im Inter Miami.
Di competition begin on 14 June and e go continue till di final wey go happun on 14 July 2025.
Di Club World Cup don enta di quarter-final stage as di top two sides from each group qualify.
Manchester City na one of eight clubs wey don qualify for di last 16 but dem don crash out.
Fifa club world cup quarter-final fixtures
Real Madrid go face Borussia Dortmund for di quarter-final game of di Fifa club world cup game.
Palmeiras go battle Chelsea, Bayern Munich and PSG go face diasef while Fluminense will face Al Hilal.
Di winners go move to di semi-finals.

Wia dis foto come from, BBC Sport
Fifa club world cup Table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport
Fifa club world cup group stage fixtures results

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport
Dis update na 2 July 2025 at 12 noon.
All Club World Cup fixtures
Friday 20th June
- Group B
PSG versus Botafogo
- Group C
Benfica versus Auckland City
- Group D
Flamengo versus Chelsea
Los Angeles versus ES Tunis
Saturday 21st June
Group C
Bayern Munich versus Boca Juniors
Group E
Inter Milan versus Urawa Reds
Group F
Mamelodi Sundowns versus Borussia Dortmund
Fluminense versus Ulsan HD
Sunday 22nd June
Group E
River Plate versus Monterrey
Group G
Juventus versus Wydad Casablanca
Group H
Real Madrid versus Pachuca
Red Bull Salzburg versus Al Hilal
Monday 23rd June
Group B
Atlético de Madrid versus Botafogo
Seattle Sounders versus PSG
Group G
Manchester City versus Al Ain
Tuesday 24th June
Group A
Inter Miami versus Palmeiras
Porto versus Al Ahly
Group C
Auckland City versus Boca Juniors
Benfica versus Bayern Munich
Wednesday 25th June
Group D
ES Tunis versus Chelsea
Los Angeles versus Flamengo
Group F
Borussia Dortmund versus Ulsan HD
Mamelodi Sundowns versus Fluminense
Thursday 26th June
Group E
Inter Milan versus River Plate
Urawa Reds versus Monterrey
Group G
Juventus versus Manchester City
Wydad Casablanca versus Al Ain
Friday 27th June
Group H
Al Hilal versus Pachuca
Red Bull Salzburg versus Real Madrid
Saturday 28th June
Last 16
Team confam versus Team to confam
Team confam versus Team to confam
Sunday 29th June
Last 16
Team confam versus Team to confam
Team confam versus Team to confam
Monday 30th June
Last 16
Team confam versus Team to confam










