America dey consider to impose travel ban on Nigeria, Ghana and 34 oda kontris? - Wetin we know

US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

At least 25 African kontris fit face partial or total US travel bans inside one new anti-immigration measure by US President Donald Trump administration, Reuters report.

According to one internal State Department memo wey Reuters see, America goment wan extend dia travel restrictions on 36 more kontris, wey go potentially ban citizens of these kontris entry into di US.

Di State Department bin raise concerns on top security, lack of cooperation on deportation of nationals and overstaying of visas among di kontris under review ova di next 60 days.

"Di Department don identify 36 kontris of concern wey dem fit recommend for full or partial suspension of entry if dem no meet di established conditions and requirements within 60 days".

Dis informate dey come afta US President Donald Trump sign one ban on travel to di US from 12 kontris. E bin cite national security risks, according to di White House.

Di US president bin tok say dem fit revise di list if "material improvements" dey and dem fit also add some kontris as "threats dey come around di world".

If dis ban scale through, e go be di third time Trump go impose travel ban on certain kontris.

Trump bin sign similar order for 2017, during im first term for office.

African kontris wey dem dey reportedly chook eye include:

  • Angola
  • Benin
  • Burkina Faso
  • Cape Verde
  • Cameroon
  • Cote d'Ivoire
  • DR Congo
  • Djibouti
  • Ethiopia
  • Egypt
  • Gabon
  • The Gambia
  • Ghana
  • Liberia
  • Malawi
  • Mauritania
  • Niger
  • Nigeria
  • Sao Tome and Principe
  • Senegal
  • South Sudan
  • Tanzania
  • Uganda
  • Zambia
  • Zimbabwe

Oda kontris include:

  • Antigua
  • Barbuda
  • Bhutan
  • Cambodia,
  • Dominica
  • Kyrgyzstan
  • Saint Kitts
  • Nevis
  • Saint Lucia
  • Syria
  • Tonga
  • Tuvalu
  • Vanuatu

If dem carry out di ban, e go be significant expansion of di travel ban wey di US goment impose earlier wey affect at least 10 African kontris.

Dis go mean say 2/3rds of African kontris go dey affected by di travel restrictions.

Among di concerns di State Department bin raise na lack of a competent or cooperative goment by some of di kontris dem mention to produce reliable identity documents. Anoda concern na "questionable security" of dat kontri passport.

Tori be say some kontris no dey cooperate in facilitating di removal of dia nationals from di United States, nationals wey di US order say make dem remove.

Some oda kontris dey overstay di U.S. visas dem give dia citizens.

Trump order increase in migrant deportations

Sojas wey dey armed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Trump latest order dey come for di middle of one new wave of protest against im immigration policies

Meanwhile, President Donald Trump don order expansion of di detention and deportation of migrants across kontri as protests against im policies kontinu.

For one post on Truth Social, Trump call on federal agencies to "do evri tin for dia power" to deliver "di single largest mass deportation programme for history", e name Los Angeles, Chicago and New York as specific targets.

These cities dey among di many cities wia large-scale protests don break out against raids on undocumented migrants since 6 June.

Trump don face legal challenges and criticism for im response to di protests - particularly im deployment of di military to stop di demonstrations.

Trump bin say im don direct di "entire administration to put every resource possible behind dis effort".

E also promise to prevent "anyone wey belittle di domestic peace of di United States" from entering di kontri.

As e dey address various federal offices wey include di Drug Enforcement Administration (DEA) and Immigration and Customs Enforcement (Ice), e write say "you get my unwavering support. Now go, get di job done!"

Di post bin come one day afta one new wave of protests against Trump policies across di kontri.

Trump also order immigration authorities to focus dia efforts on sanctuary cities - those wey limit dia assistance to federal immigration authorities - wey during di protests don become source of tension between federal and state lawmakers.

Officials for these places don defend dia legal rights to protect undocumented migrants.

Di command to expand deportations signals follow-through on Trump campaign promise to provide di "largest deportation programme of criminals for di history of America".

Why Trump announce travel ban on some kontris on June 5

Di White House say dis "common sense restrictions" go "protect Americans from dangerous foreign actors".

Inside one video wey e post on im Truth Social website, Trump say di alleged terror attack for Boulder, Colorado "underscore extreme dangers" wey foreign nationals wey dem "no properly vet", pose on di US.

Na 12 pipo injure for Colorado wen one man attack a group wey bin dey gada in support of Israeli hostages. Di man throw two devices wey dey catch fire and wey dey use makeshift flamethrower.

Di man wey dem accuse say e carry out di attack don dey identified as Egyptian citizen.

For 2017 Trump bin order im original travel ban during im first term for White House.

E feature some of di same kontris just like im latest order, including Iran, Libya and Somalia.

Critics call am "Muslim ban" as di seven kontris wey bin dey listed bifor na Muslim majority.

Di White House revise di policy and add two non-Muslim majority kontris, North Korea and Venezuela.

Di Supreme Court stamp am for 2018.

President Joe Biden, wey succeed Trump, cancel di ban for 2021, and call am "a stain on our national conscience".

E neva dey clear how far President Trump wan go wit dis planned travel ban wey dem neva tok wen dem go announce.