US stop student visa appointments as dem plan to expand social media vetting

One Harvard University student dey with fellow demonstrators during one protest in support of international students for Harvard University. E wear graduation cap and gown wit sash wey get American flag.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, On Tuesday, Harvard University students do protest in support of international students
    • Author, Brandon Drenon
    • Role, BBC News, Washington DC
  • Read am in 3 mins

US President Donald Trump administration don order embassies to stop to dey schedule appointments for student visas as e dey prepare to expand social media vetting of applicants.

Inside one copy of memo dem send to diplomatic posts, Secretary of State Marco Rubio say di pause go last "until further guidance dey issued".

Di message say social media vetting go dey stepped up for student and foreign exchange visas, wey go get "significant implications" for embassies and consulates.

Dis dey happen as Trump get mata with some of America most elite colleges, wey e believe say dey too left-wing. E say some of dem don allow antisemitism for dia campus and discriminatory admissions policies.

Di state department memo, wey BBC US partner CBS News see, direct US embassies on Tuesday to remove any unfilled appointments from dia calendars for students wey dey seek visas, but say those with appointments wey dem already schedule fit still go ahead.

Di diplomatic cable also say di state department dey prepare for "expansion of required social media screening and vetting" wey dey applicable to all student visa applications. E no tok clearly wetin di vetting dey look for.

Foreign students wey wan study for US dey usually need to schedule interviews for di American embassy for dia home country before approval.

Many institutions dey rely on foreign students for a big part of dia funding, as dem dey most times pay higher tuition fees.

Wen dem ask am about student visas, state department spokesperson Tammy Bruce tell reporters on Tuesday say: "We take very seriously di process of vetting who e be wey dey come di country, and we go continue to do dat."

Di Trump administration don freeze hundreds of millions of dollars in funding for universities and make move to deport students, while revoking thousands of visas for odas. Many of dis actions don dey blocked by courts.

White House don accuse some US universities of allowing pro-Palestinian activism on campus to dey hijacked by antisemitism.

Colleges don also accuse di Trump administration of trying to infringe upon free speech rights.

Harvard University don be focus of President Donald Trump vex. Last week, di Trump administration revoke Harvard ability to enrol international students or host foreign researchers. One federal judge block di policy.

If dem allow am, e fit deliver a tough blow to di university, where more dan one quarter of students be foreigners