Teachers and doctors for England to get 4% pay rise

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Paul Seddon
- Role, Political reporter
- Read am in 2 mins
Most doctors and teachers for England don dey offered 4% pay rise, after government accept recommendations from pay review bodies.
Di awards dey higher dan di 2.8% e bin budget for, with ministers wey say most of di remaining go get to come from existing budgets.
Education unions don mostly welcome di decision, while dem warn of cuts to school budgets without extra funding to cover costs.
But health unions don react angrily after a smaller rise of 3.6% dey offered for NHS staff oda dan doctors, including nurses and midwives.
Di health department say junior doctors, wey dey known now as resident doctors, go get an average rise of 5.4% due to one £750 top-up.
But di British Medical Association say di increase dey "woefully inadequate" and confam plans to ballot resident doctors next week over possible strike action.
Di Royal College of Nursing wey also criticise am say nurses bin get offer of a smaller rise dan doctors.
General secretary Nicola Ranger say e go dey up to dia members to "ultimately decide if e dey enough and weda dem feel valued".
Di announcements wey dey confirmed on Thursday na:
- 4% headline award for doctors, dentists, and teachers for England, as well as prison officers for England and Wales
- 3.6% rise for NHS staff for England on 'Agenda for Change' contracts, including nurses and midwives
- 3.25% rise for civil servants, including senior civil servants
- 4.5% rise for members of di armed forces, with 3.75% for senior military staff
Di education department announce an additional £615m to cover di rises, but say schools go dey asked to partially fund di awards through "improved productivity and smarter spending".
Di National Education Union, wey represent teachers, say di award no dey "fully funded" and e fit lead to "cuts in service provision" for many schools.
Di health department say cuts to "frontline services" no go dey necessary, arguing say dem fit find di money through cutting di use of temporary staff, cutting "duplication and waste", and im plan to stop NHS England.
Recommended awards of 3.25% for senior NHS managers and senior civil servants don also dey accepted by ministers. Members of di armed forces don dey offered 4.5%.
Inflation - wey be di rate prices dey increase - don fall in recent months, but e unexpectedly rise to 3.5% for di year to April, e complicate how ministers sell di deal to workers.
The Bank of England don tok before say e expect inflation to peak at 3.7% between July and September dis year, before e go slowly begin to fall.
Labour end long-running public sector strikes last summer by accepting recommended pay rise of between 4.75% and 6% for last year.
Ministers argue say di move bin dey required to stop damage to di economy - but e bin lead to Conservative accusations say dem don lose control of public sector pay.







