Jamb release 2025 rescheduled UTME results - how to check

Wia dis foto come from, Jamb
Di Joint Admission and Matriculation Board (Jamb) don release di results of di rescheduled 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).
Fabian Benjamin wey be tok-tok pesin for Jamb yarn dis one for one statement on Sunday 25 May.
Di rescheduled exam na for 379,997 candidates wey dia results get comma sake of error wey bin affect 157 centres for Lagos state and di south-east.
Jamb say dem release di results afta one professor of educational measurement and evaluation, Boniface Nworgu, review dem.
Dem say afta Professor Nworgu review di results, Jamb Chief Examiner also review dem.
"All results don dey released except dose of candidates wey bin commit examination infractions and dose wey dey slated for mop-up examinations," di statement tok.
Jamb say di withheld results of di under-aged candidates (except wia litigation dey involved) wey bin performed below di established standards go dey released.
"Such result no however qualify dem for admission, as dem don previously signed undertaking during di registration process acknowledging say only dose wey meet di prescribed standards go dey considered for under-aged special admission," Jamb tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
21,082 absent candidates go seat for di mop-up examination
Candidates wey miss di resit exam and di initial main UTME go get di chance to participate in di board mop-up examination.
"While noting di over 93% attendance at di resit examination, di meeting offer all di candidates absent opportunity to participate during di normal annual mop-up examination.
"Dis waiver also dey extended to di candidates wey for whatever reason fit don miss di initial main UTME," Jamb tok.
Jamb result withdrawal
Even though Jamb don fully release all di results of di candidates wey resit, some candidates dey unlikely to get dia result becos Jamb dey accuse dem of examination malpractice.
"All results released except candidates wey commit examination infractions and candidates set up for mop-up examinations. While releasing di results, recent discoveries particularly by di security agencies don necessitate di withdrawal of some of di results of implicated candidates across di kontri wey dem bin don release dia result," Jamb tok.
Jamb tok say dem don alert di candidates wey dem withdraw dia results through text messages on dia registered lines, dia profiles and emails.
However, di examination body tok say during di 2025 UTME examinations, dem uncover 3,000 candidates wey dey involved in examination fraud and dem go withdraw dia result as soon as more evidence dey.
CBT centres blacklisted for examination malpractice
Jamb reveal say di recent result wey dem release show fresh cases of widespread malpractice wey involve candidates, school proprietors, and Computer-Based Test (CBT) centres.
Di examination body say CBT centres wey dey involved in serious registration and examination malpractices go dey blacklisted and dem go prosecute dia owners.
"In addition, di identified individuals wey directly register di candidates wit modified pictures and biometrics go dey apprehended and prosecuted," Jamb tok.
How to check Jamb results
Candidates fit check dia score through dis method.
SMS method:
Send "RESULT" to 55019 or 66019 wit di phone number wey you use register.
You go receive SMS wit your score details.
Candidates no need to go any CBT centre or cybercafé to check results.
Di results wey dem still dey process and di ones wey dey absent go receive message like "under processing" and "absent" respectively.
Dose wey dey under investigation go receive:
- Verification Investigation
- Under Investigation (A)
- Under Investigation (B)
- Alleged Infraction














