Nigerian students dey find Universities wey dey accept low cut-off mark

Students resting under a tree

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Secondary school leavers for Nigeria dey search for universities wey fit accept low Jamb cutoff marks for dis year admission, sake of wetin Jamb take students eye see for dia 2025 University Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Jamb na di Joint Admissions and Matriculation Board - di exam body wey dey in charge of organising exams for young school leavers for Nigeria wey dem go take enter university, polytechnic, college of education and oda tertiary institutions.

Dis 2025 Jamb exam bin record very low marks across di board according to one analysis of di results wey di exam body bin release.

Almost two million students bin write di exam dis year, but na about 12,400 of dem score 300 marks.

However, Jamb later agree say dia system bin get problem and dat na di reason for di mass failure. Dia oga kpatakpata, Ishaq Oloyede even cry for national TV as e dey apologise to Nigerians for di error.

Dem also organise anoda exam for di affected students and di exam resits go conclude dis Tuesday as tori be say di result fit come out on Wednesday.

Normally, if pesin get up to 200 for Jamb, dem dey consider am as pass mark, though some universities fit admit pipo wey score 180 for some courses.

But recently, sake of di increasing poor performance by students, some universities don bring dia requirement down to 150 Jamb and rumours dey fly say di score go even dey lower dis year.

One staff of Abia State University, for southeast Nigeria tell BBC Pidgin say di school neva announce wetin dia cutoff mark go be bicos Jamb exam still dey go on, "but I no expect say e go dey lower dan 140", she tok.

Another staff of Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University, wey im former name na Anambra State University tell our tori pesin say "di university no go accept any jamb score below 150 for courses wey no relate to medicine and law".

Similarly, one staff of Sokoto State University, tok say "e dey too early for di university do decide wetin dis year cutoff mark go be, especially since Jamb neva even conclude di exams".

Di oga wey plead anonymity say di university go get dia policy meeting for August to decide, and by dat time Jamb go don also brief dem officially on wetin to do, but for last year, dia cut off mark na 140.

Brief background on JAMB result for recent years

For 2022 UTME, Jamb announce say, 378,639 candidates score above 200, 520,596 score 190 and above, while 704,991 score 180 and above.

Also, 934,103 score 170 and above and 1,192,057 score 160 and above.

For 2024, a total of 1,904,189 candidates sit down for UTME. 1,989,668 register for di exam, wey be 24.7% higher dan di figure for 2023.

According to Jamb, out of di 1,842,464 results wey dem release, only 0.4 percent score above 300, while 24 percent score 50 percent (200/400) and above.

As dem see dis kain low scores since for 2019 UTME, Jamb and institutions come conclude say make dem reduce and approve national minimum cut-off mark of 160 for university admission for Nigeria.

Again for 2022/2023 admission session, Jamb come set di general cut-off mark for universities at 140 and above, as dem see say candidates underperform dat year again.

And for dis year data, Jamb show say out of 1.5 million candidates wey write di exam, over 50 percent score below 200 for this year exam.

Some universities wey fit accept low jamb scores

Based on wetin bin don happen bifor and interview wit staff and students of some tertiary institutions for Nigeria, here na schools wey fit accept low jamb scores,

Abia State University (ABSU) Uturu - 140

Ebonyi State University - 140

Ekiti State University - 140

Delta State University - 140

Federal University Gashua - Yobe State - 140

Kingsley Ozumba Mbadiwe University, Imo State - 140

Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University, Anambra State - 150

Sokoto State University - 140

Usmanu Danfodiyo University Sokoto - 140

Benue State University Makurdi - 150

For Polytechnics:

Akanu Ibiam Federal Polytechnic - Ebonyi State - 100

Delta State Polytechnic - 100

Kano State Polytechnic - 100

Federal Polytechnic Ede - Osun State - 120

Federal Polytechnic Ayede - Oyo State - 120