Which team make di highest profit from di Club World Cup $1bn prize pot?

Chelsea

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Chelsea na di big winners for di Club World Cup - both wit di trophy and prize money
    • Author, Henry Cowling
    • Role, BBC Sport journalist
  • Read am in 5 mins

Di Club World Cup get im critics but for di clubs wey bin dey involved di competition $1bn prize pot don prove to be good business.

Now wey di first edition of di new-look tournament don complete, we fit analyse di financial rewards wey clubs wey compete get.

BBC Sport explain di breakdown of di prize money and wetin e mean for di clubs wey get am.

How much money bin dey on offer?

Di new look competition bin get a prize pot of $1bn (£726m) to give out to di 32 competing clubs, out of dat money $525m dey divided between all clubs for participation and Fifa award $475m on a performance-related basis.

Di money wey dem give European clubs for appearance dem share am based on sporting and commercial criteria, e mean say some clubs collect more pass odas for taking part.

European clubs collect between $12.81m and $38.19m just for turning up, while teams from oda continents dem give dem a set fee - $15.21m for South America, $9.55m for North and Central America, and Asia and Africa, and $3.58m for Oceania.

Fifa neva confam di individual amounts wey dem give to European clubs for taking part, so we dey use estimates from football finance website The Swiss Ramble based on Uefa club coefficient system.

Di prize money figures dey converted from US dollars into pound sterling.

Di big winners

Source: FIFA/The Swiss Ramble
Source: FIFA/The Swiss Ramble

Tournament winners Chelsea na by far di most financially successful team, dem earn about £84m, while Paris St-Germain make about £78.4m for dia run to di final.

European clubs, wey generally bin enjoy larger participation fees, make an average of around £39m while impressive runs from di likes of semi-finalists Fluminense mean say dat South American clubs make £24m on average.

Money bin dey on offer for results for di group stage, wit around £1.5m for a win and £730k for a draw.

Five clubs, including Pachuca and Seattle Sounders, bin lose all three group games dis one mean say dem only receive dia participation fee.

Auckland City hit jackpot

Despite say di prize money figures for di likes of part-time side Auckland City bin look small, di competition been dey incredibly lucrative for dem within di context of dia overall finances.

Source: FIFA/Deloitte/The Swiss Ramble/BBC Sport
Source: FIFA/Deloitte/The Swiss Ramble/BBC Sport

Di £3.3m wey Auckland City take home na around seven times dia overall 2024 revenue of approximately £488,000, while di £67m wey Real Madrid make na just 4% of dia 2024 figure of £901m.

While dis na huge positive for di part-time club, football finance expert Kieran Maguire share im concerns for di impact on oda sides from New Zealand.

Im say: "Dem don earn so much money sotay e dey difficult to see anybody wey fit compete wit dem if dem invest di money for dia playing squad.

"And dem get reason to do so becos e go boost dia chances of qualifying for di next Club World Cup.

"E good for dem, but e no necessarily dey good for di league wen you dey try to sell a competitive league to broadcasters."

Extra transfer funds

For di European clubs, di extra revenue dey welcomed as dis na way of increasing dia transfer budget.

In line wit Uefa rules, clubs dey limited to spending 70% of dia revenue on wages, transfers and agents' fees - so for every £50m dem earn, an extra £35m dey available for recruitment.

Some clubs don already pay off dia summer transfer business sake of say dem take part for di competition.

Source: Transfermarkt/BBC Sport/The Swiss Ramble/FIFA
Source: Transfermarkt/BBC Sport/The Swiss Ramble/FIFA

More dan 65% of Borussia Dortmund £57.9m transfer business so far dis summer dem don pay am off from dia participation for United States afta dem reach di quarter-final stage.

Di £27m Dortmund bin pay to Sunderland for Jobe Bellingham already dey completely paid off.

Chelsea bin spend £198m on reinforcements so far dis summer on di likes of Joao Pedro and Liam Delap - £84m of dat dey covered by dia impressive run for di Club World Cup.

Despite Manchester City surprise last-16 exit to Al-Hilal, dem still earn around £38m from di tournament - wey equate to 35% of di summer business dem don conduct so far.

In more simple terms, e don pay for dia £31m acquisition of Rayan Ait-Nouri from Wolves.

Real Madrid bin pay Liverpool a fee of around £8.4m for Trent Alexander-Arnold to sign am one month early to dey part of dia squad for di competition - dem pay dat one off afta just three matches.

"Di accountant for di football club like di idea. Di business go dey happy," na wetin finance expert Maguire tok about di competition lucrative incentives.

"But I no sure say di fans dey happy, particularly European clubs, and e go be di same for players and managers.

"We dey reach a crisis point as far as player welfare dey concerned. We fit enter a period of conflict between players and owners."