'Dem tie dem come slaughter dem like goat and chicken' - eyewitness tori how bandits attack village for Niger State

Wia dis foto come from, Zakaria Kontagora
Police for Niger State don confam say bandits attack Kasuwan-Daji village wey dey for Demo village near Kabe District.
For statement, tok-tok pesin for di Niger State Police Command, Wasiu Abiodun say na around 4:30 on Saturday night di bandits attack di village.
"Suspected bandits for National Park Forest along Kabe District, invade Kasuwan-Daji wey dey for Demo Village via Kabe, Dem burn di market, loot shops and carry items.
Im add say around 8:00a.m on Sunday morning " Joint security team bin visit di scene, say ova 30 victims lose dia lives during di attack. Dem also kidnap some pipo. Efforts dey go on to rescue dem."

Wia dis foto come from, Zakaria Kontagora
Meanwhile eyewitnesses Marcus Philips Adoka give account of how di attack take hapun.
"Dis tin hapun here for Kasuwan Daji around 5-6 pm. Bandits enta di village and wreak havoc. Dem burn houses, kill many pipo. We no get security men here. We dey call on govment to come to our aid because we no know di situation of di pipo wey dem kidnap."
Dem dey beg govment to come help dem sake of say de bin dey hear about di killings wey dey hapun for oda places now e don reach dia village..
"Dem just come push us out from our homes. We dey die like chicken. I dey ask if govment care about us? im add.
Anoda eyewitness say according to di reports wey im get from di village, dem shoot many pipo and dem tie dem wit ropes and later slaughter dem like goats and chickens.
As you dey see for hia, dem slaughter pipo and deadibodi of pipo wey dem kill for forest dey too, dem dey recover dem one by one. So far we don count about 42 deadibodi."

Wia dis foto come from, Zakaria Kontagora
According to Abdullahi Ahmed Rofia, official wit Niger State Emergency Management Agency di attack hapun on Saturday.
"Yesterday Saturday around almost 4 to 7 O.Clock for evening, dos bandit scome from somewhere around Agwara wia Kebbi State get boundary, e get one village wey dem dey call Kebbi, dem (bandits) spend almost three days dia attacking di pipo.
As dem dey come back, dem branch for Kasuwadanki wey dey under Borugu local govment but dem dey share boundary wit Agwara local govment.
Dem attack pipo wen dem reach di market, dem catch up to almost 40 pipo, tie dia hand for dia back, dem come slaughter dem wit knife."
Di Nema official say wen di bandits dey raid, dem just dey catch anybody wey dem see. Im add say for Kasuwandaki security no dey at all.
Im say di Niger State Emergency Management Agency don send pipo to go di place to check how many pipo get injury so dat dem fit give dem medications and render help.
'No matter who dem be or wetin dia intention be, we must hunt dem down' - Tinubu declare
Nigeria President, Bola Tinubu don respond to di killings of villagers for Niger State by terrorists wey dem suspect say dey run from Sokoto and Zamfara .
For statement President Tinubu say na sake of di bombing wey di United States do on Christmas Eve dey pursue di bandits.
On Sunday, January 4, 2026 oga Tinubu direct di Minister of Defence, di Chief of Defence Staff, di Service Chiefs, di Inspector-General of Police, and di Director-General of di Department of State Services (DSS) to track down and and arrest di pipo wey carryout di killings for Kasuwan Daji attack.
Oga Tinubu give dem order to make sure say di pipo face di law sharp-sharp.
Im also direct security agencies to rescue all di victims wey di bandits kidnap urgently.
For statement wey di Presidency release, wey Bayo Onanuga Special Adviser to di President on Information and Strategy sign, President Tinubu strongly condemn di attack on di Kasuwan Daji Community and di abduction of women and children.
"Dis terrorists don test di resolve of our kontri and di pipo. Dem must, diafore, face di full consequences of their criminal actions. No matter who dem be or wetin dia intention be, we must hunt dem down."
"Dem, and all di pipo wey dey aid, abet, or enable dem in any form, we go catch and bring dem to justice," President Tinubu declare.

Wia dis foto come from, Zakaria Kontagora
'Banditry na big problem for Nigeria'
Banditry and kidnapping na one of di security issues wey Nigeria dey face, especially for north central and north eastern Nigeria. See
E neva too tay wey jaguda pipo attack communities for Niger and Kwara States. Di attacks make headlines.
Bandits bin kidnap over 300 pupils, students and staff of St. Mary Catholic school for Niger State.
Di same situation bin hapun for Kwara State wia Jaguda pipo kidnap worshippers.
Earlier on for May 2025, jaguda attacks bin lead to mass deaths for central Nigeria.
Dem kill pipo, rape both old and young women, kidnap pipo and tiff pipo tins.
Different groups dey wey dey terrorise di kontri like Boko haram, Iswap and more recently Lakurawa too don join dem.








