38 abducted Kwara church worshippers regain freedom - Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

Read am in 5 mins

Di 38 worshippers wey jaguda pipo kidnap from di Christ Apostolic Church for Eruku community, Ekiti local govment area of Kwara state, north central Nigeria on Tuesday, 18 November don regain freedom.

President Bola Tinubu announce di informate for im official X account on Sunday, 23 November, although e no provide details on di rescue operation.

"Thanks to di efforts of our security forces ova di last few days, all di 38 worshippers wey dem kidnap from Eruku, Kwara State don dey rescued," President Tinubu tok.

Dia freedom dey come four days afta bandits attack dem during one evening programme for di church.

Di bandits kill two pipo and kidnap 38 worshippers according to di church.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

By Thursday, di bandits bin reach out to di church and demand for N100 million ransom for each pesin wey dem carry.

"Bandits demand say for each pesin wey dem kidnap, we pay 100 million Naira, but we tell dem say we no fit get dat kain money.

Dem say dem go call us dis evening so we fit reach one level on wetin we go give for di release of di pipo wey dem kidnap," e tok.

E no clear if govment pay any ransom to rescue di kidnapped worshippers. Di govment however, dey against payment of ransom.

Foto and short videos of di attack - wey come from di Church livestream - bin go viral on top social media and e show as di worshippers bin try to hide wen di gunmen enta di church.

Meanwhile, Kwara State Govment don order make schools for four local govment areas close sake of insecurity wey dey rise for some communities.

President Tinubu also express delight ova di escape from captivity "51 out of di 315 students" gunmen kidnap from St. Mary's Private Primary and Secondary School for Niger state on Friday, 21 November.

Di president say im cancel im trip to di G20 summit for South Africa to enable am coordinate di security efforts for di kontri.

E say im closely dey monitor di security situation nationwide and dey receive continuous updates from di frontline.

"Every Nigerian, for every state, get di right to safety — and under my watch, we go secure dis nation and protect our people," President Tinubu tok.

Earlier on Sunday, di Christian Association of Nigeria (CAN) confam say 50 of di 315 children wey gunmen kidnap from di school on Friday don escape and reunite wit dia families.

One major military-led search and rescue operation dey go on for di release of di remaining 265 children and 12 teachers wey dem carry, authorities tok.

Calling for di release of di abductees, Pope Leo XIV express "immense sadness" and urge di authorities to act swiftly.

Within dat same week for Monday, 18 November, bandits bin attack one govment girls secondary school for Maga community for Kebbi State, northwest Nigeria, and kidnap 25 school girls from dia school hostel.

Dem kill di Vice Principal and di security pesin for di school bifor dem pack di girls enta bush witout any confrontation from security pipo.

Tori later come out say two of di girls later escape, and by Wednesday morning tori also tok say anoda school girl return home but she get injury.

Meanwhile, more dan 20 of di schoolgirls still dey for di hand of di bandits.

Authorities say dem still dey try find di girls to rescue dem.

Oda major security incidents wey occur last week

Within di past week plenti bloody security situations don happun for Nigeria, from Kebbi State to Kwara State to Niger State.

Bandits suspected to be members of ISWAP kill senior Nigeria Army general Sani Uba for undisclosed location. For video wey go viral e show moment bandits shoot di army general and e fall for ground.

Kebbi State bin grab dia own share of terror within di week wen gunmen enter one Government Girls Comprehensive Secondary School kidnapp 25 students.

Di local authority later tok say di 25 students wey di jaguda pipo kidnap all of na Muslims.

For Kwara State, gunmen enter church wia worshipers dey do gathering, kill some and kidnap many. Di incident for Kwara state lead to shutdown of schools for di area by govment.

As tension still dey high on top dat one, jaguda pipo storm Saint Mary's School Primary and Secondary School, wey be Catholic school for Papiri community for Agwara Local Government Area of Niger State on Friday, 21 November, kidnap 315 students.

Although, di state govnor explain say based on di Google imagery dem review, di incident na more of a scare and missing of pipo rather dan a kidnapping.

"Yes, there was a scare, sporadic gunshots, and di children run bicos dem dey target dem. And from di Google imagery, no mass movement of pipo show, but pipo wey dey run up and down", he said.

For 2021, gunmen kidnapp dozens of students and staff from Government Science College Kagara, Rafi Local Government Niger State, Nigeria on February 18, 2021

Govment still dey battle how to solve di Kebbi kidnap incident, now dis one don happun.