Ruud van Nistelrooy take over as Man Utd interim coach afta sack of Erik ten Hag

Erik Ten Hag

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

English club, Manchester United don sack dia coach Erik ten Hag.

Dis dey come afta dia Sunday flogging for di hand of West Ham.

Manchester United bin only win one of di eight matches dem don play across all competitions.

Ten Hag bin join di team for 2022, and don carry Man Utd go two domestic trophies win wey include di Carabao Cup for 2023 and FA Cup for 2024.

For statement wey Manchester United release for dia website, dem cofam di sack say, "we dey grateful to Erik for evritin im don do for im time wit us and we wish am well for d future."

Dem add say Ruud van Nistelrooy go take ova di team as interim head coach.

Dis na as dem dey find who go be di permanent one.

Erik ten Hag during im last game for di club hala say e feel "unfair and unjust" say im team lose 2-1 to West Ham afta dem bin score for controversial late penalty.

Di result move West Ham to di 13th position for di Premiere League. Na one point ova Manchester United wey don only win three of dia opening nine games.

E sat "na di third time wey I don feel injustice for di season and e get ogbonge impact for our team and for our scores and for wia we dey for table. E no dey right."

Manchester United now dey find dia sixth permanent manager since Sir Alex Ferguson comot for 2013.

How much Ten Hag don spend?

How much Ten Hag don spend?
How much Ten Hag don spend?

How Erik Ten Hag time for Manchester United go

Di former Ajax coach, 54 year old Ten Hag take charge of di club for di summer of 2022 and carri di club go third place for di Premier League for im first season.

E also carry di team to win dia first piece of silverware for six seasons as dem win 2-0 for against Newcastle for di 2023 Carabao Cup final and finish second for di FA Cup final as Manchester City flog dem 2-1.

Im second season sef no go well in di beginning as United finish for di bottom of dia Champions League group but dem still carry trophy as dem beat Manchester City for di FA Cup final.

Bicos of dis win, di club bin trigger one year extension for Ten Hag contract but in just ova tree moths, dem sack am say e oversee United second worst start to di Premier League.

Who be di new coach, Ruud van Nistelrooy

Ruud van Nistelrooy

Wia dis foto come from, Getty Images

Ruud van Nistelrooy bin dey work as assistant coach wit Ten Hag. E start im work for di team from last summer.

Di Dutchman na 48 year old wey bin play for Manchester United in im 20s.

Van Nistelrooy don get ogbonge playing career for di club wey span from July 2001 to July 2006.

Part of di ogbonge feats wey im make for di club na to score 100 goals for im first three seasons for di club.

And den for im fourth season e take ova from Denis Law as di club all time top scorer for European competition.

E go don reach 150 goals in less than 200 starts for im fifth year inside Old Trafford.