Di ‘tattoos' wey Esan pipo for Nigeria believe say dey cure dia sickness

Wetin we call dis Video, 'Healing tattoos': Ema Udeh na body markings wey Esan people for Nigeria belive say dey cu
Di ‘tattoos' wey Esan pipo for Nigeria believe say dey cure dia sickness
    • Author, Victor Ezeama
    • Role, BBC News Pidgin

Tattoos mean different tins for different pipo. For some, na design to beautify di body, for odas na to tell dia tori or even keep memories.

But for Esan land for Edo state, Southern Nigeria dia tattoos asides from di cultural importance, na something to take tackle sickness.

Dem dey call dia tattoos Ema/Udeh – body markings wey dem dey use as treatment for splenomegaly or swollen spleen.

Splenomegaly na growth wey dey come out from di left side of pesin belle.

One public health physician, Dr Abel Oriahi say di main cause of swollen spleen na malaria or pesin wey get sickle cell anaemia.

BBC Pidgin visit Ewohimi for Edo state wia we discover say many pipo from dat region get di Ema/Udeh marking.

Young and old, e no get who dem no fit mark. Except di pesin no get di disease.

Story by Victor Ezeama and Idara Monday