From designing drones wit carton to creating fully functional drone
- Author, Abubakar Maccido
- Role, BBC
- Reporting from, Kano
Shamsuddeen Jibril and im team create hand made agriculture drone wey fit spraying chemicals in farms wey fit also detect disease in farmlands
E say im team wey dey Kaduna source 70 percent of di drone parts for Nigeria.
"My dream na to change di wey farmers dey control pests for dia farmlands wit my drones," Jubril tell BBC News Pidgin for interview.
E tok say wetin motivate am start dey make agricultural drone be say im get passion for innovation since e dey small sake of dat e use to go to school late.
Shamsuddeen Jibril also tok say dem go soon begin mass production of dia drones sake of say some farmers for Kaduna don begin dey ask am to create drones for dia farmlands.
Jibril say im dream and dat of im team, di Air Force Institute of Technology of Kaduna undergraduates, na to create solutions to di way farmers dey apply pesticides for Nigeria and Africa.

Wia dis foto come from, Shamsuddeen Jibril

Wia dis foto come from, Shamsuddeen Jibril

Wia dis foto come from, Shamsuddeen Jibril
Filmed by: Mobolaji Olatunde






