'End Bad Governance protest na my brother first and last protest'
'End Bad Governance protest na my brother first and last protest'
Abubakar na tailor for Kaduna wey police bin allegedly shoot and kll during di End Bad Governance protest wey happun for August.
Nigeria Inspector General of Police Kayode Egbetokun bin deny say anybodi die for Kaduna during di protest.
Sake of di economic hardship for Nigeria, pipo of di kontri bin enta streets to protest from August 1 to 10.
However, some pipo die and injure during di protest for some states sake of say e don turn violent.
President Bola Tinubu during im broadcast to Nigerians on 4 August bin tok sorry ti di "families wey lose loved ones for Kaduna".
Produced by Abubakar Maccido
Filmed by Mobolaji Olatunde






