'Nigeria na turn up capital of di world'
Di Kenyan popular group Sauti Sol bin break up for 2023, and since den Bien don dey grow for im music waka on im own afta almost years wit di group.
Bien tell BBC News Pidgin di risk e don dey take for im music as solo artiste, wey im bin no fit take as member of Sauti Sol wey im call “family brand”.
Di “Wahala” singer open up on top how e be for am to work wit Nigerian stars as e don work wit several of dem.
Some of di most popular work wey Bien and im group don do for Nigeria na wen dem sing wit 2Baba for 'Oya Come Make We Go', including oda bangers like 'On My Way' wit Davido and 'African Star' wit Burna boy.
As musician wey e don be for almost 20 years, e also torchlight how di music industry don grow and how social media don help wit di growth.
Producer: Faith Oshoko
Filmed by Mobolaji Olatunde






