Why I no need naked women for my content

Wetin we call dis Video, Why I no need naked women for my content
Why I no need naked women for my content
    • Author, Adesola Ikulajolu
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News
    • Reporting from, Lagos

Popular ogbonge skitmaker and actor Layi Wasabi say di kain content wey im dey create no need use nude women bifor im go appeal to audience.

Layi wey im real name na Isaac Olayiwola follow BBC Pidgin tok ontop how im journey into content creation bin start wey make am dey grow popularity.

Na Lagos dem born am but wen im papa die na im dem carry Layi go back Osogbo wia im get most of im upbringing.

Layi return to Lagos to begin im journey into content creation wey don work for am.

"Wen I bin start my content creation, I bin dey Osogbo and dey waka go Ibadan dat time too. Na wen di content creation really pick na im I move come Lagos to better di hustle," Layi tok.

Layi say wen im dey small, comedy and entertainment dey sweet am well well and im mama dey rent video casette dat time wey be say na how im begin watch 'night of a thousand life.'

"I go dey share jokes for school and follow dat kain pattern. Na how I be be dat and I dey always enta wahala wit my mama, and she go say instead make I dey face my studies," Layi tok.

Layi Wasabi dey play lawyer and oda character

Wia dis foto come from, Instagram/layiwasabi

How di lawyer character take start

According to Layi Wasabi im lawyer character na part of di real life situation wey im don see and experience bifor and na why im adopt dat kain content.

You go agree say di 'Lawyer' character of Layi na one of di display wey make im content dey relatable and acceptable to many pipo wey be say dem don even get dat kain experience.

Im say di experience bin come from wen im dey serve for one ministry of justice and im go dey see lawyer wey be say dem dey act funny even wit dia dressing.

"I notice say e get some kain lawyers wey really pick my interest. You go look dia shoe and dey wonder if na di kain same tin we study."

'My lawyer clothe old pass me'

Layi say as di lawyer cloth be so, na ova thirty years wey be say di cloth don dey and e old pass am. Even di wig wey im dey wear dey very funny to many pipo as im dey use am act different scenarios.

Nudity for content creation

Layi dey act lawyer character

Wia dis foto come from, Instagram/layiwasabi

E get some kain skit and content wey audience dey watch and dem go dey complain of how dem dey sexualise women and even how men dey always wan show dia nude body.

Dis kain pattern na wetin Layi tok say no be im own way of creating content. Im add say im no fit judge anybody but comedy na wetin pesin fit do effortlessly.

Layi wey dey known for im type of comic contents say im kain comedy no need naked women bifor e go appeal to audience.

"Di kain skit wey I dey do no need naked women but I no go judge anybody. Comedy na wetin you fit do effortlessly," Layi tok

Afta Layi bin go school wey be say im study law, na comedy im come later choose to focus on. Dis decision neva too go well wit im mama as she still dey try make im pikin go law school to become barrister.

Layi say im mama and oda family members dey support am very well for di career wey dey currently put food for im table and im go still reason di law matter later.

"My mama dey happy wit my comedy but she still dey call me to go law school to become barrister fully, but dis one wey I dey do make I do am reach one point . My family dey support me too.

Video: Idara Monday and Mobolaji Olatunde