Nigerian youths dey ‘Japa’ go Burkina Faso go find work - victims tok

Wetin we call dis Video, Several Nigerian youths don fall for fake job application
Nigerian youths dey ‘Japa’ go Burkina Faso go find work - victims tok
    • Author, Adesola Ikulajolu
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
    • Reporting from, Lagos

Plenty Nigerian youths don fall for fake job application wey make dem forcefully travel go Burkina Faso to go find work wey go pay dem in dollar.

Di rate at which job trafficking take dey spread for Africa dey alarming but many pipo no go ever think say e go sweet Nigerian youths belle to find work go Burkina Faso.

BBC News Pidgin receive tori of some young Nigerians wey experience hardship for Burkina Faso wia dem go in search for greener pasture, but e no end well.

Dis na di tori of a young Nigerian Jesse Abbey (no be im real name) wey find greener pasture go Burkina Faso in 2023 but na trafficking dem use lure am into di job wey no real.

Jesse na graduate wey dey do well for imsef in Nigeria sake of say im don establish little business wey dey sustain am for Ondo state Southwest Nigeria since goment job no show for am. By our observation, Jesse go dey im late twenties.

Dem force Jesse to sell im properties to find money wey go make am travel go Burkina Faso by land through Cotonue border only to discover say dem deceive am for di gold company job wey dem promise am.

Na Jesse childhood friend bin deceive am wit fake gold company job but im find out say na networking dem dey use dem do as one pesin go gatz lure anoda pesin into di job.

Dem pack ova 50 pesin for one room and dem gatz dey fake living large to deceive odas wey dey Nigeria say dem dey live fine but na lie.

"Wen I reach di place I meet a lot of pipo like old men, young men, girls and everybodi dey complain. Some say na dia properties dem sell to come and to go back to Nigeria dey difficult becos if dey come back Nigeria, nowhere wey dem wan go," Jesse tell BBC Pidgin.

For Jesse, na di definition of slavery and di one wey pain am pass na di one wia dem dey kollect dia phones so dem no go fit contact anybody for home.

'Dem collect my phone'

Dem force Jesse to sell im properties to find money

Wia dis foto come from, SundayDaniel/BBC

Wetin we call dis foto, Jesse na graduate wey dey do well for imsef in Nigeria bifor dem deceive am

Ontop dat kain painful treatment, di kain food wey dem dey serve dem for di overcrowded room wey dem put dem na to struggle for am say of say plenti pipo fit dey ontop one plate of food.

"Dem collect my phone, collect my sim card, I no fit contact anybody and dem refuse to give me back. Dem dey cook for di lodge but dem fit put like five pipo food for one plate

For di traffickers, di assignment to bring more pipo into dat kain fake work dey simple. All dey need to do na to make di ones wey don dey dia trap to dey live fake life and dey post fin tins wey no real.

According to Jesse, na di same strategy to lure odas into coming to Burkina Faso thinking say na Gold company but na networking business. Di chain na to bring one pesin wey go bring plenti oda pipo. Na how di pipo wey dem deceive fit deceive odas come, na like dat dem go fit get food and pay dem small commission.

"Dem fit tell us make we go find building to take picture to show pipo wey dey Nigeria make dem think say you dey okay."

"Dem fit say make you go boutique go snap picture and no be say you wan buy am, but make pipo dey think say you dey live better life in order to bring more pipo."

Jesse escape back to Nigeria wit nothing, im dey try pick im life back as im no too get any business again.

How Jesse escape comot from Burkina Faso wey be French kontri and dey also face military take-ova, na by very rare luck.

Na dis struggle of Jesse to get better life make fall for di fake job, but now wey im don return back to Nigeria, na how to survive dey im eyes.

'E take us three days to get to Burkina Faso'- anoda victim

Na condition for Nigeria make Daniel think of japa

Wia dis foto come from, SundayDaniel

Wetin we call dis foto, Daniel travel for 3 days to reach Burkina Faso

Sunday Daniel, a young graduate from Ondo state bin hear about one opportunity to go work for Burkina Faso. As im no sure of which kind work e dey go do for Burkina Faso, e do more finding about wetin dem tell am including di name of di company.

Na condition for Nigeria make Daniel think of how im fit leave di kontri go find work for Burkisa Faso for 2023.

Daniel receive message from one of im secondary friend about one company wey dey recruit for Burkina Faso say. Di friend tell am say im don travel go dia, im dey work wit dem at di moment and e get some slots wey im boss wan fill. Na di genesis of Daniel trafficking go Burkina Faso be dat sake of say im really need di job.

Video by Adekola Olawale