‘I bin dey hope for miracle make my son missing intestine reappear'

Wetin we call dis Video, 'My son small intestine miss afta dem do multiple surgeries on am for hospital for Lagos'
‘I bin dey hope for miracle make my son missing intestine reappear'

Wen surgeon tell Mrs Deborah Abiodun Akin-Bright say her 12-year-old son small intestine dey miss, she say she bin first no beleieve am.

Di 12-year-old boy dey battle for survival afta dem perform multiple surgeries wia dem confam say im small intestine dey miss.

Di multiple surgeries bin take place for one private hospital and anoda goment facility, Lagos State University Teaching Hospital, (Lasuth).

For di interview wit BBC News Pidgin, Mrs Abiodun say she never understand how small intestine go comot her son bodi and nobody know how e take miss.

 Deborah Abiodun

Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu on Sunday promise to pay for di medical treatment of di one 12-year-old boy.

Di govrnor visit di boy and im mama Deborah Abiodun wia im dey receive medical treatment for Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth), Ikeja on Sunday.

Tok-tok pesin to di govnor Gboyega Akosile, on im X page tok say di govnor go provide financial and medical resources wey go save di boy life.

On Saturday, di management of Lasuth tok say dem refer di 12-year-old boy come di hospital afta di private hospital don perform two surgeries on am.

Di hospital management explain say na experienced paediatric surgeon and oda professional doctors perform di surgery and dem get all di video clips .

“E require extensive optimisation for facility bifor we fit perform corrective. Di surgery dey carried out by an experienced paediatric surgeon and her team discover certain strange tins.

We get video clip of dis findings. We inform di mother about dis findings but she no agree. Di hospital get di comprehensive report of di findings by di panel wey dem don set up to look into di matta,”Lasuth management tok.

Video by: Adesola Ikulajolu and Olawale Adekola