'Living wit gland tumour for ten years almost make me question God'

Wetin we call dis Video, 'Living wit gland tumour for ten years almost make me question God'
'Living wit gland tumour for ten years almost make me question God'

Madu Chisom bin dey live normal life bifor im mouth begin swell up.

Di middle aged man bin no know wetin dey happun to am until dem discover say na gland salivary tumour. Dis na swelling from inside di mouth.

Di tin start wit toothache wey be normal tin wey dey do plenti pipo. E later turn to sometin wey begin worry am.

“As e take start na 2014. Normally I dey get toothache but dis one come dey swell small small and bifor you know, di swelling become big,” e tell BBC News Pidgin.

As a music promoter Chisom tok of how im bin dey manage and distract imsef to live by di day. But e endure di growth for up to ten years.

Madu Chisom tok as e look back to di journey of how im overcome di tumour and di period im consider to kpai im sef.

Produced and edited by Monday Idara