Woman wey dem comot 3kg fibroid from her belle tok wetin her eye see

Wetin we call dis Video, Princessa bin no sabi say wetin dey grow for her belle na fibroid
Woman wey dem comot 3kg fibroid from her belle tok wetin her eye see

Wen Princessa Oreo bin first notice swelling for her belle, she no too sabi wetin e be sake of say she neva stay wit pesin wey get dat kain disease bifor.

Na later she know say wetin dey grow for her belle na disease wey dem dey call 'fibroid'.

Fibroid na abnormal growth for uterus and e dey be like tumor (tissue wey go form for inside body wen abnormal cells grow).

At 35 years, she begin nurse di sickness wey make her begin try plenty tins just to find cure.

Produced by Victor Ezeama, Edit by Monday Idara